How Ghana crash out of 2022 World Cup

Wia dis foto come from, Getty Images
South Korea and Portugal don qualify for di round of 16 for di ongoing Fifa World Cup.
Na goals difference na im determine who comot and who qualify for Group G.
Ghana wey lose 0-2 to Uruguay and Uruguay wey win di match don cari dia bags dey go house.
Ghana Andre Ayew miss first-half penalty for Ghana, minutes before Giorgian de Arrascaeta score two goals for Uruguay but e no reach.
For di oda match South Korea beat Portugal two goals to one to qualify for di last 16.
Ghana and Uruguay bin face each oda one time, dat be in 2010 during de quarter finals stage of de World Cup for South Africa.
Despite playing 1 - 1 draw den, Uruguay beat Ghana 4 - 2 on penalties to advance to de next stage.
Dis be de second time de two teams meet in 12 years.
End of Di one wey oda users dey read well well
Live updates of de game as e happun
SECOND HALF
Full Time
Ghana 0-2 Uruguay
Portugal and South Korea qualify for di last 16
Last minute of Extra time'
Tension evriwia for dis match na only one chance remain for Uruguay
No penalty!
Edison Cavani fall inside Ghana area but referee say no penalty, dem dey check VAR.
E jam bodi wit Alidu Seidu.
Extra time
Na few minutes remain to stoppage time.
As e be so Uruguay need one more goal to qualify if not dem and Ghana go comot.
As Portugal beat Korea 2-1
85 mins: We don enta di final five minutes of di match.
80 mins: Nearly!
Beta work by Kamaldeen for di left, im dey at alert since im enta di match.
Ghana dey mount pressure on Uruguay for di penalty area but Antoine Semenyo shoot di ball wide!
77 mins: Substitution
Ghana don make two changes, Salis Abdul Samed and Inaki Williams dey replace Daniel -Korfi Kyereh and Antoine Semenyo.
70 mins: Na about 20 minutes remain for Ghana to save dia World Cup progression, Kamaldeen Sulemana drive try enta near Uruguay box but Sergio Rochet clean am up afta Thomas Partey touch di ball poorly.
68 mins: Substitution!
Luis Suarez don comot from di match, Edison Cavani replace am. Facundo Pellistri also comot for Nicolas de las Cruz
Luis Suarez collect yellow card for time wasting
Second half don start o!
Substitution
Ghana dey make double changes
Dem don replace Andre Ayew and Jordan Ayew wit Kamaldeen Sulemana and Osman Bukari.
FIRST HALF
Half-time
54 mins: Ghana 0-2 Uruguay
Referee don blow whistle to end di first half.
52 mins: Daniel Amartey of Ghana jam bodi wit Pellistri for Ghana penalty area as im bin wan protect di ball and allow Lawrence Ayi-Zigi to gada imsef.
49 mins: Uruguay dey press Ghana, and e be like say dem fit score anoda goal. And Ghana neva really enta di game and create beta chances .
47 mins: Na 8 minutes remain for half-time to reach
37 mins: Mohammed Kudus get corner kick for Ghana .
31 mins: Goal!
Ghana 0-2 Uruguay
Uruguay score dia second goal, na De Arrascaeta second goal for di match.
26 mins: De Arrascaeta of Uruguay na im score di goal to break di deadlock afta Ghana miss dia penalty.
26 mins: Goal!
Ghana 0-1 Uruguay
24 mins: Small pushing bin dey before Ghana take di penalty but Ghana players gada for circle to guide di penalty spot.
Plenti drama full dis game again.
20 mins: Penalty miss!
Goalkeeper save Andre Ayew penalty
16 mins: Ghana want penalty but referee say na offside, dem dey check VAR.
Na Mohammed Kudus wey fall as Sergio Rochet come out to take di ball.
Ghana don get penalty against Uruguay and Darwin Nunez chop yellow card.
12 mins: Arsenal Thomas Partey pass dey blocked by Tottenham player Rodrigo Bantancur as Ghana moves break down.
8 mins: Mohammed Kudus win free-kick for Ghana inside Uruguay half, na chance to play long ball but referee blow foul.
4 mins: Darwin Nunez bin get chance for goal but e fall, e no balance well.
I min: kick-Off
Ghana 0-0 Uruguay
Match don start!
Di game wey world pipo and Africa dey wait for! More controversy and drama go dey today ?
‘I no dey owe Ghana apology’ - Luis Suarez

Wia dis foto come from, Getty Images
Uruguay striker Luis Suarez reveal for prematch press conference say he no dey owe Ghana apology for handling de ball to stop de Black Stars from scoring in de 2010 World Cup.
De referee show Suarez red card wey dem send am off in de last minutes of extra time.
“I no fit apologise for it, I go apologise if I injure player but I take red card for de handball” Suarez talk.
“De Ghana player miss de penalty, no be me," he add.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Ghana starting 𝗫𝗜 to face Uruguay
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Uruguay starting 𝗫𝗜 to face Ghana

Wia dis foto come from, Seleccione Uruguaya/GFA
Uruguay starting 11
Valera
Gimenez
Coates
Olivera
Pelistri
Valverde
Bentancur
de Arrasceta
Suarez
Nunez
Substitutes
Muslera
Godin
Vecino
De la Cruz
Sosa
Torreira
Vina
Gomez
Torres
Cavani
Caceres
Canobbio
Ugarte
Rodriguez










