Uefa Champions League Table: PSG, Bayern Munich lead standings, Chelsea, odas fall below top 10

Wia dis foto come from, Simon Bruty/Anychance/Getty Images) Sathire Kelpa/Eurasia Sport Images/Getty Images)by Alexander Hassenstein/Getty Images)
Chelsea, Liverpool and Bayern Munich beat dia opponents woto-woto as match day three of di Uefa Champions League end on Wednesday.
Two-time champions Chelsea sama Ajax Amsterdam 5-1. Liverpool wey recently get bad run for di Premier League travel go Eintracht Frankfurt home, dem wire dem 5-1.
Bayern Munich sef no relax at all as Club Brugge collect 4-0 from di former champions.
Na total of 28 goals club score on Wednesday night while on Tuesday night games record 43 goals.
Di league stage of di Champions League don begin dey take shape small-small but di journey still far.
Results of Wednesday matches

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wia dis foto come from, BBC Sport
Matchday three for dia champions league bring ova sixty goals especially from di big scoreline on Tuesday wey result to 43 goals and also scatta statistic for red cards and oda data dem.
How di Champions League Table be after matchday 3
PSG still dey lead di table afta Match day three, oda big games wey dey di top 10 include Real Madrid, Bayern Munich, Inter Milan, Arsenal, Manchester City and Barcelona.
Liverpool and Chelsea dey second half of di table.

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wia dis foto come from, BBC Sport









