Maundy Thursday wetin e be and how dem dey celebrate am?

Maundy Thursday

Wia dis foto come from, Getty Images

Maundy Thursday na day wey Christians worldwide dey observe to mark Jesus Christ Last Supper with im disciples.

Di occasion dey remind Christians of di importance of humility, selflessness, and service to oda.

Na important day for di Holy Week, wey dey start wit Palm Sunday and end wit Easter Sunday.

Maundy Thursday wey also dey known as Holy Thursday, na important day for di Christian calendar.

Maundy Thursday dey take place di day before Good Friday.

Wetin be di meaning of Maundy Thursday?

Di word Maundy na Latin language wey mean, mandatum, or command, and dis dey refer to di instructions Jesus bin give im disciples for di Last Supper.

For di Last Supper, Jesus command pipo to love one anoda and den go on to wash di feet of im disciples as act of kindness.

Wetin be di history behind Maundy Thursday?

Di history of Maundy Thursday go far back to di first century AD wen Jesus bin share di Last Supper with im disciples.

Dis tori dey recorded for bible inside Matthew, Mark, and Luke, and Christians dey celebrate ever since.

Ova di centuries, various traditions don come out, including di washing of feet, di stripping of altars, and di sharing of a special meal.

How pipo around di world dey celebrate Maundy Thursday?

Pope Francis

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Pope dey lead di Chrism Mass for Holy Thursday

For many kontris, di day dey known as Holy Thursday and na public holiday but for Nigeria no be public holiday.

Na key day for di Christian calendar, e dey mark di end of Lent.

Maundy Thursday na part of Holy Week and e always dey fall for di last Thursday before Easter.

To celebrate Maundy Thursday, di Pope - wey be di head of di Roman Catholic Church - traditionally dey wash and kiss di feet of 12 pipo - usually dem be members of di church.

For UK, Di monarch dey hand out special coins to members of di public.

For 2022, di King – wey be Prince Charles at di time – bin carry out di traditional coin giving ceremony on behalf of di Queen.

And for 2023, King Charles do am for di first time as di monarch wit im wife, den Queen Consort Camilla.

Im give a Maundy gift to 74 men and 74 women. Di number of gifts represents im age, so for 2024, e dey expected to give out 75 gifts.

Each person receive two purse, one red and one white, na inside di purse dem put di Maundy coins.

Each year, di monarch go travel to cathedrals and abbeys around di kontri and give gifts to local pipo, and also give special coins to pensioners.

Wetin dey happun on Maundy Thursday for Nigeria?

Catholic Church for Nigeria, dey hold two mass on Maundy Thursday for morning and evening.

Di first service in di morning na Chrism Mass. Na for dis Mass di Bishop go bless di three main oils wey di Catholic church dey use throughout di year.

Di oils na Oil of Chrism, Oil of Cathecumens, and di oil of di sick. Na only once a year dem dey bless dis oils.

Also, na for dis Mass all di priests for di diocese go renew dem priestly vows.

Di evening mass na 'Mass of di Lord's Supper'.

E dey commemorate Jesus last supper wit im apostles.

Na for dis Mass di priest go wash di feet of 12 pipo to remember how Jesus wash im apostle feet.