I find out for YouTube say my marriage don over - Stella Damasus

Stella Damasus

Wia dis foto come from, Screen shot/Stella Damasus Instagram

Nigerian actress Stella Damasus don confam say her marriage to Daniel Ademinokan don over.

Damasus, tok for one interview she do with ogbonge TV Host Olateju Oyelakin wey pipo sabi as Teju Babyface.

She say na for ontop YouTube she discover say her marriage wit di filmaker don end.

Di actress say she dey single now as she don already dey divorced.

Di 45-year-old, actress explain how e happun say her ex-husband travel and e suppose come back house, na so she begin dey receive message for her phone from family and friends about her marriage issues.

“No I no dey married. I don divorce, I dey single, na di first time wey I dey tok am be dis,” for almost three years.

“I see say my marriage don end ontop YouTube. Di man in question travel and im suppose come back, na im I begin dey receive messages from family and friends say why I no tell dem about my marriage issues,” Stella tok.

Stella say dis na di first time she go dey tok about di mata for public.

Skip YouTube post
Allow Google YouTube content?

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites. YouTube content fit contain adverts.

End of YouTube post

Na for 2014 tori come out say, Damasus and Ademinokan marry each oda.

Stella wey get two children bin don marry before Ademinokan.

Stella bin marry Jaiye Aboderin for 1999. She born two pikin for di marriage before Aboderin die for 2004.

Damasus and Ademinokan bin relocate go United States of America and na dia dem bin dey live until dia marriage crash.

Stella Damasus na ogbonge Nigerian actress wey dey popular for her incredible talent as an actor. Di actress don feature for several movies including Widow, Between, Gone, Two Bribes and a Baby, Desperate and Dangerous among odas.

Stella marry Jaiye Aboderin, wey be her first husband for 1999.

She born two pikin, Angelica and Isabel, for di marriage before her first husband die for 2004.

Di announcement of her marriage to Ademinokan come out for 2014.

Meanwhile, Daniel Ademinokan, na actor, director and filmmaker for Nollywood movie industry.

E start im career as scriptwriter before e start to dey do filmmaking, afta e study filmmaking for di Digital Film Academy for New York, United States.

Daniel release di award-winning movie “Black Friday” for 2010.

For di past 20 years, e don write script, produce and direct several Nollywood movies.

Ademinokan get a son with im first wife, Doris Simeon - David Ademinokan.

She also be Nollywood actress.