Death toll of Kano Mosque attack rise to 12 – Suspect tok why e burn di Mosque during prayer

Foto of di mosque wey dem burn for Kano

11 pipo don die and odas injure afta one man set mosque on fire during morning prayer for Kano, North west Nigeria.

Imam wey dey lead di early morning prayer and three odas na im die afta di attack on di mosque.

Di man wey im identity no dey known bin set fire to one mosque for Laraba Abasawa wey dey for Gezawa Local goment area.

Di incident wey happun early on Wednesday make pipo begin run upandan for di area to find how to save and rescue pipo wey trap inside di mosque.

One pesin from di community bin tell BBC News Pidgin say di man allegedly pour petrol and set fire for di mosque wen about 40 pipo dey pray - e den lock di mosque.

Di chief medical director, Murtala Muhammad Specialist Hospital, Dr Hussaini Muhammad, wey bin attend to di patients, tok say 24 pipo na im dem carry come di hospital.

E add say, one of dem bin don die bifor dem reach di hospital.

"My broda die instantly afta we carry am come hospital". Brother of di deceased worshipper, Muttaka Halliru, tok.

Haliru add say "At di time wen di fire happun, I dey house dey prepare to go for Sub'h prayer, den I hear Sulaiman dey shout fire for mosque."

"Di remaining 22 pipo, get serious injury, sake of say plenty of dem get burn from head reach toe, while di oda one get burn for im back and hand," e tok.

However, Kano Police tok say dem don arrest one man wey dem believe say na im set di mosque on fire during di early morning Sub'h prayer.

Dem tok dis one for one statement wey Police tok-tok pesin SP Abdullahi Haruna Kiyawa release for im social media.

Di suspect wey be 38 years, claim say im action na sake of wahala wey e dey get wit im family members sake of inheritance.

E tell police pipo say im family dem no share di inheritance well, and those wey e believe say cheat am be di pipo wey dey for mosque wen e bin torch am, di statement tok.

SP Abdullahi Haruna Kiyawa tok say dem dey hold di suspect for police station as dem kontinu to investigate di matter.

Dis na di third time wey attack on mosque happun for Kano in recent times.

On 28 November 2014, plenti pipo die for gun and bomb attack during Juma'at prayers for central Mosque for Kano, wey officials tok say, casualty figures reach almost 400, and dem dey suspect say na Boko Haram do di attack.

Di Central Mosque na wia di influential Muslim leader, di Emir of Kano, dey usually go lead prayers.

For Islam, e get di laws wey concern how dem dey share dead pesin property among im pikins or im heirs.

One Islamic preacher, Dr Yahuza Ishaq Muhammad Jama'are, wey be Chief Lecturer for FCT COE Zuba Abuja Nigeria, tok about di controversy wey dey follow diz laws.

Dr Yahuza say dis kain controversy wey dey come from di specific shares wey dem allocate to different family members, wey fit dey different from wetin people dey do for many societies wey dey today.

One major kasala for inside Islamic inheritance laws na about gender inequality.

Dis laws fit give different shares to men and women but e dey give male double of wetin daughters go collect.