Guinness World Records confam Hilda Baci as di new record holder for longest cooking marathon individual category

Hilda Baci

Wia dis foto come from, Hilda Bassey Cook-a-thon

Guinness World Records don confam Hilda Baci as di new record holder for longest cooking marathon individual category.

Dem announce am on Tuesday.

Hilda Baci become di most popular pesin for Nigeria wit her attempt.

Di chef wey her real name na Hilda Effiong Bassey, become popular and capture di heart of her nation for cooking for more dan 90 hours non stop in her attempt to break Guinness world record.

Since bin cook ova 100 dishes, most of di food wey she cook na Nigerian dishes.

Di 26-year-old Nigerian chef begin to cook on Thursday 11 May and continue to Monday 15 May, she bin cook over 100 pots of food during her four-days she spend for di kitchen.

Why Guinness World Record no award di 100 hours Hilda Baci bin claim

GWR add say afta dem review all di evidence, dem fit now say Hilda Effiong Bassey, better known as Hilda Baci, officially break di record for di longest cooking marathon (individual), with a time of 93 hours 11 minutes.

Hilda bin attempt to set a record of 100 hours, however, dem deduct almost seven hours from her final total because she mistakenly take extra minutes for one of her rest breaks early on wen she start.

Explaining further, GWR say: "As with all ‘longest marathon’ records, di participant dey permittedto take a five-minute rest break for every continuous hour of activity. Dis rest breaks pesin fit put am togeda and take am at once. Na di only times Hilda fit to go use di bathroom or sleep during di attempt."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Na Lata Tondon (India) bin set di previous record of 87 hours 45 minutes for 2019.

Hilda say she attempt dis record to “put Nigerian food on di map” and “to inspire young African women to chase dia dreams.”

“I also decide to break dis record to truly push my limits and test my abilities,” she add.

Hilda say she prepare for di event by creating one 35-item menu “as a guide” for every meal wey she go cook.

She ensure say she get di necessary ingredients to make each recipe, with her team wey dey buy more food items while di cook-a-thon bin dey go on based on wetin dem need to top up.

'Hilda Baci fans crash Guinness World Records website'

Hilda Baci

Wia dis foto come from, Hilda Baci

Millions of pipo for Nigeria and abroad follow Baci attempt for social media as e continue to gada momentum and trend from wen she start. Millions follow her progress on her Instagram live stream.

Guinness World Records say Hilda cook-a-thon in fact bin dey so popular sotay dia website crash for two days sake of di high volume of traffic dem receive from her plenti loyal fans.

'Rules of di game'

Hilda Baci

Wia dis foto come from, Guinness World Records

According to GWR, Hilda bin dey required to follow several rules during her record-breaking cook-a-thon:

  • She must dey prepare or cook at least two food items at any time
  • She dey permitted to get a sous-chef to assist in prepping di work, washing up, and cleaning di kitchen area, but na she must do all di cooking as di individual wey dey attempt di record

One of di most important rules of di food-related record attempts na say food must not waste all items must dey consumed afta cooking.

Many Nigerians bin troop to di venue wia she dey cook to eat and dem also donate di leftover food to a foundation.

Hilda Baci na a graduate of Madonna University, Nigeria, wia she get a degree in sociology, na afta school Hilda decide to start her culinary career. She say she bin dey inspired by her mama, Lynda Ndukwe, who also be chef.