Di only flying eye hospital for di world enta Ghana to save pipo eyes for free

a boy who benefited from the free surgery in an infectious smile
Wetin we call dis foto, Dis be di third time di flying eye hospital enta Ghana since 1990
    • Author, Komla Adom
    • Role, Senior Journalist, BBC Pidgin
    • Reporting from, Accra
  • Read am in 4 mins

You go believe say any hospital dey for dis world wey dey inside aeroplane?

Well, make I shock you.

Follow me enta di only flying eye hospital for di world – as dem visit Ghana to do eye surgeries for pipo for free.

Meet six-year-old Alvin, one of thousands of pipo wey get eye problem for di Ashanti region and oda parts of Ghana.

E get lump for im right eye wey dey become big as e dey grow.

Di kindergarten school child travel wit im mother for four hours from di Bono East region to Kumasi for free surgery by Orbis.

Alvin mother say she dey fear how tins go be – but she dey hopeful.

"Di lump for Alvin eyes start wen e be two years old. E dey become big as e dey grow. I no know how to feel right now. But I dey expect say afta di surgery, everitin go dey okay. Wey e go fit continue im education."

Apart from Alvin, dem do surgery for many odas.

Alvin dey smile wit im mama after surgery
Wetin we call dis foto, Alvin mother say fta di surgery dem remove di bandage wey she see say everitin dey fine wit her son.

Orbis be non-profit organization wey dey work for ova 40 years around di world to prevent blindness and restore di sight of pipo for places wia eye care dey hard to reach.

Dem dey train local eye care workers inside dia flying hospital before dem dey do free surgeries for local partner hospitals

Dem screen hundreds of pipo wit different eye problems togeda wit di local care workers.

Afta di surgery, Alvin mother dey happy; her bubbly son go continue im school without any fear.

"By di Grace of God, everitin dey fine. I dey worried bifor wey I dey wonder how di surgery go be. As dem carry am go di theatre, I make sad."

Alvin mother say "afta di surgery dem remove di bandage wey I see say everitin dey fine. Im eyes dey fine now."

She add say, "Alvin be happy child, wey we go make sure e reduce playing until di wound heal finish. We be grateful to Orbis for dis free surgery, make God bless dem to help oda pipo for Ghana wey dey need dis kind surgeries."

before and after shots of Alvin
Wetin we call dis foto, About 26.3 million pipo for Africa get one form of visual impairment, about 20.4 million get low vision and 5.9 million dey blind, according to WHO

Oda pipo dey in line for dis free eye surgeries for di Komfo Anokye Teaching Hospital

Orbis director for di flying eye hospital oga Maurice Geary say: "Globally, 1.1 billion pipo get vision loss. 90% of dis number be preventable wey mean say dem fit treat am or e fit be prevented."

"From dis number wey dey live wit preventable vision loss, nine out of 10 pipo dey live for lower middle income kontris."

Di group believe say pipo anywhere for di world need to get access to proper eye care weda dem be rich or poor.

Di Orbis flying eye hospital travel to more dan 90 kontris around di world wey dem train thousands of doctors, nurses, biomedical engineers and oda eye care workers since 1982.

Plane wey dem write flying eye hospital dey di picture wit pipo wey dey come down from am.

Wia dis foto come from, THE FLYING EYE HOSPITAL/INSTAGRAM

Wetin we call dis foto, For ova 40 years, di flying eye hospital visit more dan 90 kontris wey dem train thousands of eye care workers and perform plenti surgeries for free

For Africa, dem get long-term projects for Ethiopia, South Africa, Zambia, Cameroon and Ghana.

Dis be di third trip by di flying eye hospital to Ghana since dia oda visit for 1990 and 2006.

"For dis project for Ghana, we set up di whole airplane like simulation centre wey we use virtual reality and artificial eyes to train eye doctors, we also dey do live surgical training inside di airplane," oga Maurice Geary tok BBC News Pidgin.

E explain say, "in addition to dat simulation training inside di airplane, we also carry clinical team to Komfo Anokye Hospital for Kumasi wey dem dey work wit local eye care teams to train staff wey dem dey do surgeries for patients inside di operating room."

About 26.3 million pipo for Africa get one form of visual impairment.

Dis include about 20.4 million wey get low vision and 5.9 million wey dey blind, according to di World Health Organization (WHO).

But Orbis and dia flying hospital dey work wit African kontris and oda local partners to reduce dis numbers, one pesin at a time.