Pipo faint, some hide under umbrella as hot weather dey 'bake' pipo for Southern Europe

Several pipo dey take shelter from di heat under umbrellas for Murcia for south-eastern Spain

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Several pipo dey take shelter from di heat under umbrellas for Murcia for south-eastern Spain

Most part of southern Europe dey face serious heat, as Greece dey see temperatures wey reach 40C (104F) or more.

Authorities don close di Acropolis, di kontri most popular tourist attraction during di hottest hours of di day to protect visitors.

Di European Space Agency (ESA) say Italy, Spain, France, Germany and Poland fit see extreme conditions.

E fit reach 48C for parts of Italy, wey go make am become "di hottest temperatures wey dem go ever record for Europe", according to di European Space Agency.

Di hottest temperature wey dem don ever record for Europe na 48.8C for Sicily for August 2021.

Reports dey of plenty pipo, including tourists wey don collapse for di heat for Italy. At least one pesin don die.

Di kontri meteorological society don call di heatwave Cerberus afta di three-headed monster wey feature for Dante Inferno.

Di weather agency don also issue red alert warning for 10 cities, wey include Florence and Rome.

One woman queue to fill bottles wit water for Rome as she dey hide from di sun wit a towel

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One woman queue to fill bottles wit water for Rome as she dey hide from di sun wit a towel
One tourist from di UK receive help near di Colosseum afta e faint sake of di heatwave for Rome

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One tourist from di UK receive help near di Colosseum afta e faint sake of di heatwave for Rome
One pesin dey cool off for one fountain for Turin, northern Italy

Wia dis foto come from, Shutterstock

Wetin we call dis foto, One pesin dey cool off for one fountain for Turin, northern Italy
Tourists cover demselves wit towels for di southern Spanish city of Malaga

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Tourists cover demselves wit towels for di southern Spanish city of Malaga
Two women wear hat to protect themselves from di sun for Malaga

Wia dis foto come from, Shutterstock

Wetin we call dis foto, Two women wear hat to protect demselves from di sun for Malaga
One woman and one dog dey drink water from one fountain for Madrid park

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, One woman and one dog dey drink water from one fountain for Madrid park