Woman wey born quintuplet lose all five children hours afta birth

Wia dis foto come from, Getty Images
One Nakuru Couple wey welcome Quintuplets on Tuesday evening lose all di five babies a day afta dem born dem.
Di family of Simon Ndung'u one 28 year old matatu operator confam say di babies pass on for di Nakuru Level 5 hospital for Kenya wia doctors bin closely dey monitor dem.
Dem bin rush di 25-year-old first time mum, Margaret Wangui enta theatre wia doctors deliver am of di five babies.
Dem bin put di four girls and one boy on life support immediately afta dia birth since dem born dem prematurely at 25 weeks.
Babies dem born at or before 25 weeks of pregnancy dey considered extremely pre-term.
According to di hospital, dem lose di four girls and one boy as a result of organ failure.
“Di internal organs of di five infants bin neva develop fully”, hospital management tok.
Di medical superintendent of Nakuru level five general hospital, Dr Aisha Maina bin first tell local tori pipo for press briefing on Wednesday afta di news of di rare birth begin make di rounds on local media, say di chances say di babies go survive dey minimal sake of the pre-term birth.
End of Di one wey oda users dey read well well
"In dis case dis na di first time wey for our facility we go get incident say one mother deliver five children and e dey well documented say wit multiple pregnancies, dis na high risk ." Aisha tok.
Two of di newborns pass on in di morning while di oda three pass on later in di day.

Wia dis foto come from, Screenshot
‘Visitation from heavens’
One member of parliament wey dey represent Bahati Constituency wia di couple dey live bin first hail am as visitation from heavens wen she first receive di news of di birth of a quintuplet by Simon Ndungu and im wife, Margaret Wangui.
Her office bin visit di families wit supplies of essentials and basic goods.
She say Simon na di sole breadwinner of di young family and say di Bahati Constituency dey blessed to receive di bundles of joy.
She share fotos of wen she visit di family for hospital on her twitter page.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
She later express her shock afta she receive di news of dia passing.
"A sad ending. Rest in Peace (RIP) to di five angels," Madam Njoki write.
Speaking to di press on February 1, Ndung'u, bin tok say im no expect say im wife go deliver five children.
"Di pre-natal scans bin show us say she dey expect three children. Na one ultrasound during her last trimester later reveal di oda two," e tok.
Dem don later bury di children amidst tears.
Reports from local media suggest say dis na di third death related to di birth of quintuplets for di kontri.
For 2019, one woman from Kakamega wey deliver five children bin die while receiving treatment for one hospital.
Doctors say na blood clots bin cause di chest pains she complain of before her death, say e block vessels for her lungs.
For 2017, one set of quintuplets wey dem born for Kisii also die afta dem contract pneumonia days afta birth.














