Former Deputy President of Kenya Rigathi Gachagua escape attack

Wia dis foto come from, Getty Images
Former Deputy President of Kenya Rigathi Gachagua suffer attack for di Limuru area of di kontri.
Tori be say oga Gachagua bin suppose attend burial for Limuru wen a group of pipo enta di place, attack am.
Di deputy president bin wan also stream di event live but e no happun sake of of di incident.
Additionally, videos and photos wey don go viral online show say many pipo wey follow Gachagua go di event wunjure, and odas begin bleed afta di attack.
Local tori pipo report say cars wey di former vice president carry also damage but Gachagua dey okay.
Di incident happun aft aim kwanta wit im former oga, President William Ruto.
Police neva comment on di incident. Di former vice president also neva tok.
Kenyan lawmakers for October pass di motion to impeach di Deputy President Rigathi Gachagua.
Na 281 members of parliament bin support bid, dem meet di two-thirds majority threshold requirement.
Later in di same month, Kenyan senators vote to remove oga Gachagua from office despite im failure to testify for im impeachment trial afta im lawyer tok say im sick and dey for hospital.
Di required two-thirds of di 67 senators bin vote to impeach am on charges wey included corruption, inciting ethnic divisions and undermining di goment.
Kenyan govment for early November swear-in a new deputy president Kithure Kindiki.
Kindiki replace Gachagua afta president William Ruto nominate am go di Senate House for consideration.
Allegations wey dem sama former deputy president Rigathi Gachagua
Gachagua bin chop accuse say e acquire assets wey worth 5.2bn Kenyan shillings ($40m; £31m) inside di two years since e become deputy president - allegedly acquired through corrupt means.
Di former deputy president say most of di properties in kwesion na from im late brother estate.
During di trial, one of Gachagua lawyers, Elisha Ongoya, tok say all di allegations against di deputy president na "either false, ridiculous or embarrassing".
Andrew Mulwa, former chief executive of di Kenya Medical Supplies Agency wey be di second witness, bin face tough questions ova im allegations say e dey intimidated by one call from di deputy president to return documents for one cancelled tender for mosquito nets wey di president dey accused say e interfere wit.
"Dis na di first time I receive call from a sitting Deputy President and request for documents wey dey under investigations. Oga Speaker, for my 15 years of public service, I neva dey asked to do dat," e tok.
Gachagua don deny di allegation and describe am as "ridiculous and baseless", and im legal team don point out say dis bin come wen di process don already dey completed, and argue say no money dey lost.
One third witness, Abdi Mohamud, di deputy chief executive of di Ethics and Anti-Corruption Commission, give evidence ova allegations of conflict of interest wey relate to di mata as well as allegations say di deputy president bin receive gifts in form of cows from di public.










