Misery for Ghana as Niger beat di Black Stars 2-1 for home for dia last Afcon qualifying game

Daniel Sossah in action

Wia dis foto come from, FEDERATION DE NIGERIENNE DE FOOTBALL/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Niger bin score from a corner as Daniel Sossah head di ball into di Ghana net
Read am in 9 mins

Sudan don join Angola to qualify for di 2025 Afcon for Morocco despite Niger 2-1 win vs Ghana.

Sudan and Angola dia final group F game end 0-0, so Angola finish di group wit 14 points, Sudan wit 8 points.

Niger end di qualifiers wit 7 points on third wit Ghana last without a win throughout di qualifiers wit only 3 points.

Umar Sako im injury time header from a freekick secure all three points for di Mena of Niger afta Jerry Afriyie im equalizer afta im enta di pitch.

Westham forward wey be captain for di Black Stars win last minute penalty to equalize but im miss di penalty.

Bifor di game, coach Otto Addo tok say dem dey play for pride but afta 90 minutes, na Niger wey win di game.

Sabi pipo tok say dis na di lowest level for di Black Stars as dem fail to qualify for Afcon for di first time in 20 years.

Westham forward Mohammed Kudus captain di new-look team for Ghana vs Niger for di Accra sports stadium in dia final group F Afcon qualifier.

Stadium bin empty as fans no show up.

Coach Otto Addo dey under pressure to resign afta im fail to qualify di team. Di Ghana football association already announce say dem do do one meeting on Wednesday to evaluate di performance of di Black Stars for dis qualifiers.

How di match happen

Second Half

Referee blow whistle for di game to end. Niger beat Ghana 2-1

90+5 MISS! Kudus take di penalty wey im miss am, goalkeeper Tandja bin save di westham star player im penalty.

Mohammed Kudus bin try to dance inside di area to score - na so Badamassi foul am. Referee point to di spot. Kudus go take am

90+4 PENALTY to Ghana

Ghana take di corner but Niger don clear am.

90+3" Dat na di second header wey Niger take score Ghana for dis game. time dey run out for di blackstars to see if dey fit to grab late equalizer.

91" GOOOOOAAAAALL! Umar Sako don rise to head Rahim im cross into di ghana net. Niger lead 2-1

90+1 Sossah comot wey Loukeman Ali don enta

Dem add 5 mins to dis game

Niger bin dey change two players as medical team don dey treat one of dia players - Yakubu for ground

87" CHAAANCE! Counter for Ghana - Ernest Nuamah lead di attack wey im play di ball into Afriyie and Kudus but di westham man don dey wait for di ball na so Badamassi clear am

Di ball don fall to Kudus, im carry di ball enta di Niger area bifor using im weak right foot to shoot, na so di defense block di ball

86" Nuamah try to take on one man but im fall for ground, referee say play on.

84" Ghana bin dey try to create sometin now but di ball no fit cause any trouble

83" CHAAANCE! Kudus don hit di freekick wey di keeper punch am to di bar for corner.

For dia last game v Angola, Jordan Ayew bin score one freekick from 30 yards. Kudus and Bukari don dey stand bifor dis ball. Na who go take am

81" Freekick for Ghana in front of di Niger box, good area for pesin wey get left foot

80" Mamudu don defend one cross wia Niger don put for box bifor Kudus win freekick

78" Ebenezer Annan bin try to reach one long ball , im take first touch but di ball don roll enta di Niger box wey dem defend am

77" Ghana bin dey make anoda change, Terry Yegbe don comot wia Mamudu don enta di pitch

76" Niger win anoda corner as dey play am short. Remember dia first half goal na thru corner.

74" CHAANCE! Niger build up and dem pass di ball inside di Ghana defense but di final ball dey weak. Manaf don catch am

73" Niger bin get throw-in for di left side of Ghana area but dey don waste am - Ghana try to build anoda attack

Niger don make anoda change

71" CHAAANCE ! Abu Francis try to head one corner into di Niger net but di ball go ova di bar.

69" As tins stand now Niger get 5 points Ghana get 4 wia Sudan maintain 8 points wit dia game vs Angola also 0-0 at dis point

Ghana coach Otto Addo bin enta di pitch to celebrate dat goal, na so di referee don warn am

67" GOOOOOOOAAAAAAAL! Jerry Afriyie wey enta di pitch not long ago don score from one Ernest Nuamah cross. 1-1

66" Ali bin foul Abu Francis for midfield

65" Yellow card for Umar Sako as im hold Kudus as di Westham man don dey step on top gas wit di ball for di counter

Na back-to-back action now for dis game, na so Niger don win corner afta some fine play

63" Daniel Sossah try to head one ball on goal but Manaf don comot wey im catch am

62" Time don dey go for Ghana to find dia equalizer, but Niger also still remain dangerous

60" Terry Yegbe don clear one cross wey Niger bin play from di rIght side, Kudus begin di counter wia im play di ball forward but goalkeeper comot to clear am go throw.

59" Defender Simpson dey try to pick out im colleagues wit one long ball ova di top but im waste possession

58" Ghana don dey make anoda change. Ransford Yeboah dey comot wia Jerry Afriyie dey enta di game wit di number 7 jersey

55" Ghana bin dey get closer and closer - between Kudus and Nuamah dey almost try to create something but di Niger defense dey alert

54" CHAAANCE! Ebenezer Annan collect one thru ball wey im try to cross but upon di second try di ball go out for corner despite calls for penalty.

52" Bukari don win freekick for im opponent area - di freekick by Nuamah dey poor, wey Niger try to counter attack

51" Bukari don try to attack but im touch di ball too hard wey di defender clear am.

Freekick to Ghana, wey dey take am quick, but Ransford Yeboah no fit reach di ball.

49" OFFFSIDE! Referee blow whistle as Hainikoye don dey offside

48" CHAAANCE! Osman bukari smash one shot wey go wide afta Ghana attack on di left

47" Niger take di freekick short but di final shot no enta.

Isaac Afful neva return for di second half, na im Ebenezer Annan don replace.

Ebenezer Annan wey don enta di game for Ghana get yellow card afta im foul di Niger striker in front of di Ghana box.

46" Players don comot enta pitch for second half.

First Half

HALFTIME

45+4" Ernest Nuamah tink say im win freekick afta one Niger player push am but referee rather blow whistle for halftime.

45+3" Niger players dey try to keep di ball

45+2" CHAANCE! Niger almost score own goal as defender Rahim im backpass to im keeper dey too strong but di ball go corner. Di keeper don dey lucky

45+1" Niger bin try to hit Ghana but Razak Simpson defend well.

Dem add 4 mins

45"Kudus pass di ball to Kingsley Schindler wey im cross am into di Niger box, Ibrahim Sulemana don head di ball ova

43" Dey don carry Nasser on top stretcher to leave di pitch. Niger gat to make one change. Yankubu don replace Garba Nasser.

41" Nasser di Niger defender don hurt. Im get treatment but di medical team dey help am to waka off di pitch, Im no fit continue.

40" CHAANCE! Ghana dey create anoda chance as Ernest Nuamah dribble and create space for imserf bifor im play one weak shot wide off di post. Kudus no happy wit di decision to shoot di ball

39" Ghana bin make one change - Osman Bukari don replace Nathaniel Adjei as Ghana bin dey chase di equalizer

37" Ernest Nuamah again try to beat Rahim but di skills don scatter wey Nuamah foul im marker.

35"CHAAANCE! Ernest Nuamah create chance wey im cross di ball inside di box, Kudus shoot but di Niger defense clear di ball, wia di West Ham man fall for ground inside di box - referee say play on

34" OFFSIDE! Kairou don enta di offside trap wey Ghana bin set. Linesman raise flag

33" Ibrahim Suleman don lose possession for midfield for Ghana wey Niger try to attack.

32" Freekick to Ghana as Kairou foul Adjei in di Ghana area

31" Ernest Nuamah take one corner for Ghana but referee blow whistle for freekick afta im spot some infringement

28" Ghana bin dey lose dia shape wit faulty passes for di midfield

25" CHAAANCE! Niger get anoda chance to score wit Sossah again afta one attacker beat Isaac Afful for di Ghana defense wia im cut di ball back to Sossah; but di striker im effort go wide.

23" Niger now get 7 points as tins stand now, wia dem dey third for di group behind Angola and Sudan

22" Afta dat goal, Niger almost score anoda one as Sossah bin enta di box but im shot no trouble di Ghana keeper.

21" GOOOOOOAAAAAALLLLLL! Niger don score from di corner. Striker Badamassi bin beat di Ghana goalkeeper from inside di box to score. Niger lead 1-0

20" From di corner, Kingsley Schindler don sit for ground im say dey don foul am, but referee award anoda corner to Niger

19" Razak Simpson try to defend one long ball into di Ghana area, wey im concede corner kick

18" Dangerous play by Nathaniel Adjei for di back as im give away possession wia Niger begin to pepper di Ghana defence, but dem recover to clear di ball

17" Ghana try anoda attack from di left but Isaac Afful im cross beat everyibodi inside di box.

16" Ernest Nuamah try to pick im striker wit one pass thru di defense but di ball too hard wia Niger don collect di ball

15" Niger bin dey press di Black Stars for dia own defense wey make dem dey play back passes

Di oda game between Sudan and Angola also dey 0-0 at dis time. Wetin dis mean be say if tins stay dis way, Sudan go join Angola qualify for di Afcon for Morocco

13" Nathaniel Adjei from Ghana try to shepherd one ball for goalkick but im Niger marker don foul am.

12" Isaac Afful bin sit for ground afta foul from Kairou. Di game bin dey see plenty small small fouls for di middle of di park.

10" CHAAAAANCE! Niger bin attack di Black Stars area as Kairou try to touch one cross into di net, but keeper Manaf don save am. Bifor dat chance, one Ghana player bin fall for di middle of di pitch

So far both teams no create any proper chance

9" Ghana player Kingsley Schindler don sit for ground afta one light touch on am. Referee blow for freekick in di Ghana area.

8" Ghana goalkeeper Abdul Manaf Nurudeen don comot im box to clear one long ball.

7" OFFSIDE! Isaac Afful wey be one of di local based players wey di coach call for dis match don enta di Niger offside trap

6" Ernest Nuamah na di danger man for Ghana so far as im dey carry di ball to attack di Niger area.

5" Jerry Yegbe don hit one low shot from outside di box but im neva trouble Tandja di Niger keeper.

4" Ghana don try to attack wit Ernest Nuamah and Kudus but di ball don slow down as dem reach in front of di Niger area

3"OFFSIDE! Ransford Yeboah bin try to reach one ball ova di top to beat di keeper but referee blow whistle for offside

2" Badamassi don take di freekick but im waste am, Ghana keeper don catch di ball

Afta di first few seconds, Niger don win freekick for di Ghana area afta defender Razak Simpson bin foul Badamassi

1" Referee don blow whistle for match to start

Team squad

Niger team photo

Wia dis foto come from, FEDERATION DE NIGERIENNE DE FOOTBALL/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Niger go dey witout dia captain Youssouf Oumarou sake of two yellow card suspension

Niger starting XI: Tandja (GK), Sako, Nasser, Kairou, Sossah, Badamassi, Katkore ©, Youssif, Rahim, Hainokoye, Ali

Ghana starting XI: Manaf Nurudeen (GK), Kingsley Schindler, Nathaniel Adjei, Terry Yegbe, Razak Simpson, Isaac Afful, Abu Francis, Ernest Nuamah, Ibrahim Sulemana, Ransford Yeboah, Mohammed Kudus ©

Ghana team photo

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Dis na di first time Ghana go miss di Afcon in 20 years, and di dia coach Otto Addo dey under pressure to resign

Head-to-head

Niger bin dey ranked 125th by Fifa.

Di last time Niger appear for Afcon na 2013 wia dem comot for group stage. Dem go hope say dis time dem fit qualify for di tournament for Morocco in 2025.

Before dis game, Ghana and Niger bin don meet each oda 15 times, wit 11 wins for di Black Stars and 2 defeats wit 2 draw.

Di last time di two teams meet for di African nations championship on 28 January 2023, Niger win 2-0.

Di oda Black Stars defeat happun on 29 July 1988 (0-3) for international friendly.

Di first draw between dis two teams happun on 17 February 1982 for di West Africa nations cup; dat game end 2-2.

But for di first leg of di 2025 Afcon qualifiers for di Stade Municipal de Berkane in Morocco, both teams settle for 1-1 draw.

Ghana bin lead dat game wit a goal from Alidu Seidu for di 44th minute bifor Niger equalise for di 81st minute.

Ghana get dia biggest win against di Mena of Niger for di Afcon on 15 February 1969; di Black Stars win dat game 9-1.

For coach Otto Addo, dis na “game of pride for Ghana. We no wan finish last for di group, so we go play to win, to be third and for pride".

Niger coach Badou Zaki

Wia dis foto come from, FEDERATION DE NIGERIENNE DE FOOTBALL/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Niger coach Badou Zaki say Ghana na ogbonge football kontri but dem no be di same team 5, 6 years ago.