How flirting fit help your relationship

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, William Park
- Role, BBC Future
For some pipo e just be like dem born dem with gift of flirting, while many odas say na skill wey dey hold dem back. Wetin dey differentiate di pipo wey get game from those wey no get and how you go fit build am up?
Imagine say pesin dey siddon alone or inside crowded bar dey wait dia friend on busy Friday night, then di bartender come sight di lonely pesin come meet am start gist.
Di bartender smooth sotay soon, di customer don relax forget say di friend don late sef. Di customer just dey enjoy di flirting, sake of say why not.
Gurit Birrbaum wey be professor of psychology from Reichman University say "wen pesin flirt wit you, you dey feel valued and di way oyu dey look your self weda you set go increase".
For dat bar scenerio, di pesin wey bartender dey flirt wit dey for inside relationship. (Birnbaum tok say even pesin wey dey inside relationship, flirting with odas dey expected. "afta sometime, pipo go start to dey daydream about oda pipo, e no mean say anytin spoil for di relationship.")
But sometin dey sup for wetin dey happun for di bar, even dey na sometin wey fit happun for real life, dis particular one plus di bartender dey happun for virtual reality wey Birnbaum create.
Birnbaum bin dey reason how pipo for long term relationships go start to dey fantasize about anoda pesin and she bin reason weda if you flity with virtual bartender, e fit stop pesin for committed relationship to flirt with pesin for real life?
She say, "I think say dis safe space fit help pipo control dia desires and help dem to maintain dia current relationships. I fint tink anytin wey I want and then I go dead am here. And I no need do wetin I dey fantasize".
End of Di one wey oda users dey read well well
Afta di pipo wet do di experiment comot dia toasting bartender VR headset, dem meet either one fine interviewer or one fine stranger wey dey find help (di stranger sef na researcher wey dey act for di role).
Wetin dem notice be say di pesin wey VR bartender just toast finish no too send di fine interviewer and no spend time like dat to help di stranger, unlike who just follow di bartender yarn. Birnbaum say e be like say di virtual toasting stop dem from real life temptations. Di pipo also tok say di interaction also make dem want dia partner pass.
Birnbaum suggest sat flirting with strangers wen pesin dey relationship fit help dia bond with dia partners but e also fit spoil mata.
She say pipo gatz sabi wia you and your partner go match brak on top dis firtinf tin so e no go turn sometin else.
She say di tins wey fit make harmless flirting tun to cheating dey very small.
She say, "wen pipo see infidelity as normal sake of say for instance, you friends dey cheat, e dey more likely say you sef go follow". Dis na wetin dem dey call "contagious infidelity".
Birnbaum say pento personalty traits fit make some pipo less likely to cheat pass odas. For instance, narcissitic pipo or pipo wey get attachment insecurities dey more likely to cheat pass odas.
How to learn di art of flirting

Wia dis foto come from, Getty Images
As careful flirting fit be good tin, plenty pipo say dem no know how to do am, Wen dem ask almost 7,000 male Reddit users, dem say number five of di 43 reasons why dem dey dey single na say dem no fit flirt.
Luckily, flirting sometin you fit learn, Afta three hous wey dem teach some adults how to flirt plus including how to look more confident wen you dey tok, dem score higher for dia flirting ability.
Oda tins pesin fit learn on how to flirt na expansive body posture wey mean to tander like big pesin, and look who you dey follow tok for eye and raise your head, fit dey learnt too.
Dis kain move na some tine wey for both men and women dey increase di way dem dey want you romantically.
Dis fit be di case sake of say, we dey look taking space as dominance and being expansive we dey see am as openess. You fit feel di effect bith ofr real life speed dating and dating profiles online.
Professor of psychology for Bucknell University for America, T Joel Wade say "no be like say we go see fine pesin say okay make I spread, na sometin wey dey happun naturally".
E explain say di way dis behaviour dey happun na by either spreading of body or spreading of property to show say pesin dey comfortable and belong for di space.

Wia dis foto come from, Getty Images
Even though generally flirting na sometin wey dey happun openly, e fit dey coded, wey professor of psychology from St Mary University for Canada, Maryanne Fisher explain as tins wey you tink say no be flirtting at all.
Pipo dey sometimes flirt by rubbing had for her. Fisher say na self grooming. "Di scope na to fine more for your eye".
Differences dey for flirting, for men, na openly by wetin dem say or do weda dem straight or gay. Women na codedly and no be mouth dem dey use tok am.
Oda coded examples of flirting na wetin dem dey call "tie signs" like eye contact, hugging, laughing at jokes, to sharing food.
Outside flirting, taking your partner last name for marriage or wearing ring na signs. Fisher say, "tie signs na wetin dem dey do for pesin back to show say you no dey available. If you wan show say your partner na your own e go easy to put your hand for dia bodi than to tell pesin to comot dia".
But if dis flirty tie signs no dey accepted well, na way to tell di pesin wey wan tiff you from your babe how deep una relationship be.

Wia dis foto come from, Getty Images
Wade add say those coded flirting fit help so di pesin wey dey toast fit get excuse say dem no dey feel dia toastee like dat sef.
Normally men dey overestimate romantic interest, like dem go see friendliness as attraction nad women dey underestimate am and na wi di idea of "friendzone" come from.
Fisher say, "Smiling wey at least for Canada na sometin wey be normal ba? Na way to calm mata down and increase friendliness bit straight men go see woman dey smile, tinks say oh she like me."
Some businesses sef dey use dis over perception of flirting take sell market.
According to Fisher dem dey put women as front of house, like greeters for restaurants.
She say, "lawsuits dey America wia women say pipo toast dem sake of say oga tell dem make dem smile and by force yarn ith customers wey di customers come see as sexual".
So e reach to ask, di virtual bartender bin dey really toast di customer or dem just dey do dia work well?













