How bombing for Pakistani mosque kill at least 59 pipo

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Carrie Davies in Peshawar, Laura Gozzi & Malu Cursino in London
- Role, BBC News
At least 59 pipo don die by one bomb wey apparently target policemen wey bin dey pray for one mosque inside di Pakistani city of Peshawar.
Di mosque dey within di tightly-guarded police headquarters area.
Prime Minister Shehbaz Sharif say "terrorists want create fear by targeting those wey dey perform di duty of defending Pakistan".
No group don tok say na dem carry out di attack, but dem don link am to di Pakistan Taliban.
Di group bin end one ceasefire for November, and violence don dey rise since.
One section of di building dey destroyed and officials say pipo dey buried under di rubble.
Early reports say bomber wey bin sit for di front row blow imsel up, but dem neva confam dis and no group don claim reponsibility for di bombing.
One hospital spokesman tell di BBC di death toll stand at 59, while 157 pipo dey injured.
End of Di one wey oda users dey read well well
Muhammad Ijaz Khan, Peshawar capital city police officer, tell local media say between 300 and 400 police officials dey present for di area for di time of di blast.
Di mosque dey one of di most tightly controlled areas of di city, wey include police headquarters and intelligence and counter-terrorism bureaus.
For statement, Sharif tok say those behind di incident "no get anything to do with Islam".
E add say: "Di entire nation dey stand united against di menace of terrorism."
Di blast take place during afternoon prayers ifor north-western city, around 13:30 (08:30 GMT), near di kontri border with Afghanistan.
One video wey dey circulate for social media and wey BBC don verify show say half of one wall don caved in.
Di mosque dey covered in bricks and debris as pipo dey clim ova di rubble to escape.
One rescue operation still continue inside di mosque and "dem don take out more bodies," Peshawar city Deputy Commissioner Shafiullah Khan tok.
"Currently our priority na to save pipo wey dey buried under di debris," Khan add.

Wia dis foto come from, EPA-EFE/REX/Shutterstock
Mohammad Asim, one spokesman for di Lady Reading Hospital, say some of those wey injure dey for critical condition.
"Na emergency situation,"Asim add.
Lady Reading Hospital for Peshawar declare emergency, and dem tell BBC dem still dey receive those wey injure during di explosion - and dey call for blood donations.
Pakistan Taliban dey among groups wey don bin carry out attacks in di past. Dem bin end ceasefire for November, and violence don dey increase since then.
Last March, Peshawar na di arget of anoda bombing, wey kill dozens for one Shia mosque.
For di capital, Islamabad Police issue security high-alert and say security for all entry and exit points to di city don increase.













