How Paris dey prepare for di Olympics and Paralympics?

Olympic rings for Paris, wit Eiffel Tower for background

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 7 mins

Di Olympic Games go open for Paris on 26 July, wen thousands of competitors go parade on boats on di Seine through di centre of di city.

France goment don promise say "unprecedented" security operation go guard di opening ceremony and di Games venues during di competition.

Wen dem wan hold Paris Olympic and Paralympic Games?

Di summer Olympics dey begin from 26 July to 11 August, wit 10,500 athletes wey go compete in 329 events.

Di Paralympics go start from 28 August to 8 September, featuring 4,400 athletes in 549 events.

Na 206 kontris dey represent for di Olympics, and 184 at di Paralympics.

More dan15 million tourists dey expected in Paris during di Games.

Wia Olympic and Paralympic events go take place?

Di main athletics events go hold for di Stade de France, outside Paris.

However, na 15 Olympic and 11 Paralympic go dey di venue in central Paris. For example, di Pont d'Iena go host cycling event and di start and finish point for di marathon go hold at di Hotel de Ville and Les Invalides.

Map showing select Olympic and Paralympic venues for Paris

Swimming events go take place in di Seine in central Paris.

However, tests wey dem do in mid-June show say levels of E. coli for di river na 10 times di maximum level wey sports federations don set.

Di organisers of Paris 2024 say dem dey confident say sunnier weather in July go kill off di bacteria, making di Seine clean enough to swim in by di time di Games start.

On 17 July di mayor of Paris, Anne Hidalgo, enta di river to try and prove say e dey safe.

Mayor of Paris Anne Hidalgo swims in the Seine

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Mayor of Paris Anne Hidalgo dey swim in di Seine to reassure pipo about di river cleanliness

How France security forces dey prepare for di Olympics?

Di chief organiser for Paris 2024, Tony Estanguet, don say di Games go dey protected by "unprecedented" security operation.

Between 35,000 and 45,000 security personnel go guard Games venues and police di Olympic opening ceremony along di Seine.

Di plan na for di national teams to parade in barges along 6km (3.8 mile) stretch of di Seine through di centre of Paris.

Na di first time in di history of di modern Olympics wey dem go organise dis type of ceremony

Di original plan na to give free tickets to 600,000 members of di public to watch from di banks. However, di goment dey worried about threats such as drone attack, and so spectator numbers don return back to 326,000.

Dem go invite ova 220,000 of dem as guests and 104,000 go be members of di public wey don buy tickets.

Dem don put up "anti-terrorism perimeter" around di area alongside di Seine in central Paris. Di 20,000 pipo wey dey live and work dia gatz get passes to enter di restricted zone.

Artist's impression of the Olympic opening ceremony on the Seine
Wetin we call dis foto, Di opening ceremony for di Olympics go feature parade of athletes on boats on di Seine

France Prime Minster Gabriel Attal don tok say intelligence services don uncover two plots against di kontri by suspected Islamic militants for early 2024.

For May, dem detain one man on suspicion of planning attack on di torch relay for Bordeaux, and dem arrest anoda man in di south of di kontri ova plan to attack di football stadium wey be di Olympic venue.

French soldiers training for Olympic security duties in Gap, in southern France
Wetin we call dis foto, French soldiers don do special security training ahead of di Olympics

Di French goment dey use about 20,000 sojas and more dan 40,000 police officers to provide security. Dem also receive support of about 2,000 troops and police officers from oda kontris.

Security services don dey screen one million pipo wey dey involved in di Games, including athletes, residents wey dey live close to di Olympic venues, medical staff and volunteers.

France Prime Minster Gabriel Attal tok say di intelligence services discover two plots against di kontri by suspected Islamic militants for early 2024. "Di terrorist threat dey real, e strong," e tok.

How much di Games go cost?

Di organisers insist say di Paris Games go dey less wasteful and more environmentally friendly dan previous events.

For dis reason, 95% of di Olympic and Paralympic sites na either existing structures or temporary ones.

Di cost of putting on dis year Games na estimate of nearly 9bn euros (£7.6bn). Dis go make am less expensive dan any of di last four for Tokyo, Rio de Janeiro, London and Beijing.

Most of di funding na from private companies, ticket sales and sales of broadcasting rights.

However, di French goment auditors say di goment go need pay out between 3bn and 5bn euros ($3.3bn and $5.5bn) for costs such as policing di Games.

Champions medals for the Paris Games, made out of iron from the Eiffel Tower

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di champions medals for Paris 2024 na iron from di Eiffel Tower

Di organisers say dem dey use as much recycled materials as dem fit. For example, di champions medals na iron from di Eiffel Tower. Dem go also minimise carbon emissions for di Games sites.

However, reports bin say dia plans don dey compromised by national teams wey order some 2,500 air conditioning units for dia rooms in di Olympic Village.

Di Games go push up dia prices for Paris?

Dem estimate say 15 million pipo go visit Paris during di Games, both from abroad and from oda places for France. Dem dey expected to spend 2.6bn euros ($2.8bn) in di city.

Hoteliers for Paris don push up dia prices in anticipation of di big rise in demand, according to one report from research firm SiteMinder wey dem publish in early July.

Di report say di average room rates go double for di Games.

However, e also say many hotels dey report unexpectedly low sales, and bookings for di period na only about 40% higher dan di previous years.

Bus and metro fare dey also double in di capital during di Games. Paris' Louvre art gallery don increase dia entrance fees by almost 30%.

Dem don ban Russia from Paris 2024?

Russia and Belarus no dey allowed to send dia teams, becos of Russia invasion of Ukraine and Belarus support for dem.

Competitors from dose kontris dey allowed to take part as neutral athletes.

Dem no go allow dem parade in opening ceremony and dem no go fit sing dia national anthems, or raise dia national flags, if dem win medals.

Opening ceremony of the 1984 Friendship Games in the Soviet Union

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Soviet Union hold "Friendship Games" as rival to di1984 Olympics and Russia go do di same for 2024

Russia tok say dem dey "vex" for athletes treatment and e don announce "World Friendship Games" for Moscow and Yekaterinburg for September.

Di Soviet Union hold similar event for 1984, afta dem ignore di summer Olympics wey happun for Los Angeles.

President Emmanuel Macron tok say Russia don dey conduct propaganda campaign to undermine di Paris Games.

Dis include putting out stories wey claim say e dey badly organised.

Dem don ban Israel?

Russian foreign minister Sergei Lavrov criticise di International Olympic Committee (IOC) say dem no ban Israel from taking part, becos of im military operation for Gaza.

However, IOC president Thomas Bach reject di demand and confam Israel participation.

One opinion poll suggest say 44% of Parisians tink hosting di Olympics na "bad tin", as pipo dey plan to leave di town.

Bus and metro prices go double for Paris during di Games.

Actors model life-size versions of Les Phryges, the two mascots for the Paris Olympic and Paralympic Games

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Les Phryges motto na "Alone we go faster, but togeda we go further"

Di Olympic and Paralympic Village na new aquatics centre wey dey north region of Paris wey dem sabi as Seine-Saint-Denis - one of di poorest parts of France.

Charities complain afta hundreds of squatters dey evicted from buildings close to di new venues.

Games venues in di centre of Paris go dey cordoned off to di public and extensive traffic restrictions go dey.

A number of Metro stations and railway stations go dey closed for part or all of di duration of di Games.

"Paris go dey unbearable," one resident tell di BBC. "Impossible to park; impossible to move around; impossible to do anytin."