US visa ban: 'We don marry but neva fit live togeda'

Wetin we call dis Video, 'We don marry but neva fit live togeda'
US visa ban: 'We don marry but neva fit live togeda'

Adenike don know Chris for five years and don dey married to am for over one year, but dem dey live separately because she never fit visit im country.

For December 2025, President Donald Trump expand US travel ban to include partial restrictions for additional countries including Nigeria.

Dis ban wey take effect from January 1 2026, go impact students, tourists and families like Adenike and Chris.

Dis couple, na just one in many odas wey dey feel di effect of di US travel ban wey Trump bin sama Nigeria.

"For me and my wife to spend time togeda, we gatz meet up for different kontris of di world. Nigeria dey too far from di US, e dey challenging for my family to come visit." Chris tok.

Chris say e no easy for im family to dey travel come Nigeria sake of di distance, so e gatz dey meet up wit im wife for anoda kontri.

For di wife, Adenike, she say dem don already dey process dia visa bifor di ban and e dey shocking to hear about di visa restriction and how e fit affect dem.

"For me, di news bin dey shocking becos three months ago, we bin receive di good news say dem don approve for us to move to di NBC stage."