'Our sisters die for Sosoliso plane crash, till now we still dey fear to fly'

Wia dis foto come from, Ilobi family
- Author, Karina Igonikon and Tamara Ebiwei
- Role, Reporter
- Reporting from, Port Harcourt, Abuja
- Read am in 7 mins
20 years ago, Sosoliso Airlines plane, Flight 1145 wey bin dey go Port Harcourt from Abuja di Nigeria capital wit 110 pipo on board crash land, come catch fire for di Port Harcourt International airport on 10 December, 2005.
Chinemerem Ilobi and Onyinyechi Maduka (Nee Ilobi) bin dey 12 and 15 years dat time.
Dem be sisters of two victims of di Sosoliso plane wey crash and for di first time, dem dey finally speak about wetin hapun.
Dem tell BBC News Pidgin say dem still dey feel di impact of di plane crash wey take di lives of dia two elder sisters.
Ijeoma Ilobi wey be di first daughter of di family of nine children bin dey 28 years while Nnenna wey be di third daughter bin dey 24 years.
Dem bin get a promising future as di two of dem bin don graduate, do dia National Youth Service Corp (NYSC) bifor di crash cut dia lives short.

Wia dis foto come from, Ilobi Family
"Di Sosoliso plane crash kill my elder sisters, Nnenna Ilobi and Ijeoma Ilobi, di moment dem tell us about dia death na di most painful news I don hear for my life. I no fit wish my enemy, my sisters die, dem no tell us bye-bye.
Onyinyechi say even as time don pass like dis, dem still dey fear to enta flight becos e dey remind dem of how dia sisters take die.
Dem tell BBC News Pidgin say two of dem enta di same flight same time for di first time since di incident hapun two months ago and na cry dem cry throughout di journey for air.
"Two months ago na di first time wey me and my sister enta flight togeda, we bin dey fear well-well, we begin cry sake of fear say make wetin hapun to my two sisters no repeat again, if e hapun pipo go tok say we bin no learn lesson from di first one, na wetin just dey go through our mind."
Chinemerem say to enta flight travel na wahala for her, say she dey fear to di point wey be say her hands go dey shake.
Di two sisters tell BBC Pidgin say di impact neva leave dia family and dem still dey inside di shock and trauma.
"My papa no fit take am, e die, only my mama dey hold on and she dey 70 years now. Our elder sister wey dey in between di two wey die, she no wan even tok about am for our family WhatsApp group."

Wia dis foto come from, Ilobi family
How Sosoliso plane crash hapun
Di Sosoliso Airlines Flight 1145 (SO1145/OSL1145) na a scheduled Nigerian domestic passenger flight from Nigeria capital Abuja to Port Harcourt, Rivers State for southern Nigeria.
At about 2:08pm local time on 10 December 2005, di flight from Abuja crash-land for di Port Harcourt International Airport.
Di aircraft, a McDonnell Douglas DC-9-32 with 110 pipo on board, slam into di ground and burst into flames and dem bin recover seven survivors and rush dem to hospitals, but only two of dem survive.
Dat crash na di second air disaster to occur in Nigeria in less dan three months dat year, after Bellview Airlines Flight 210, bin crash on 22 October 2005 for reasons wey dem no know, killing all 117 pipo wey bin dey on board di flight.
Investigation into di Sosoliso crash by Nigeria Accident Investigation Bureau conclude say di crash dey attributed to di pilot decision to keep descending on di airport even though di aircraft bin don pass di minimum decision altitude.
Di aircraft slam onto di grass strip wey dey between di runway and di taxiway. E come slide and hit a concrete drainage culvert wey dey located near di runway. Di collision come break di plane into different parts and di tail section immediately destroy and as di engine bin dey di drainage, e break, di fuel spill and di aircraft burst into flames. Di fuselage and di cockpit wey dey in flames, continue to slide for a few hundreds metres before e finally come rest on di taxiway.
Further investigation reveal say Sosoliso Airlines bin no include wind shear recognition and recovery for dia simulator training program.
Only two pipo survive di Sosoliso crash
Of di 103 passengers and 7 crew members, na only two survive although seven survivors bin initially dey rescued. Many passengers survive di initial impact but die in di fire wey follow.
Oda passengers later die from dia injuries. Port Harcourt Airport bin get one fire truck and no ambulances.
Popular Televangelist Bimbo Odukoya, pastor of the Fountain of Life Church, bin dey on di flight. She no survive di crash.
None of di seven crew members survive di crash. Out of di 60 teenagers from Ignatius Loyola Jesuit College; one boarding school for Abuja, 59 of dem die with Kechi Okwuchi being di only survivor from her school.
How survivor and victims family mark di 20th anniversary of Sosoliso crash

Wia dis foto come from, Kechi Okwuchi/Facebook
E dey make me reflect on life' - Kechi Okwuchi
"E dey unbelievable say so much time don pass already. 20 years na big deal." Na so Sosoliso survivor, Kechi Okwuchi tok as she reflect on di 20th anniversary of di crash.
She say she bin dey 16 years wen e hapun and now wey she dey 36, so much don happen from dat day till dis moment, but she say evri time di day roll around, for everyone wey dey affected by dat accident, e dey ground dem
"At least for me - e dey make me face di reality of mortality; di fact say life no dey promised, tomorrow no dey promised, anytin fit hapun to drastically change di course of your life. So e dey make me reflect on life."
Okwuchi say for evri milestone anniversary she dey always dey Nigeria and di school, Loyola Jesuit School dey always hold a memorial but dem cancel di one for dis year.
For dis 20th anniversary she say di feeling she get on dat day wey e hapun no go ever go away for di rest of her life as she remember evritin wey hapun dat day clearly.
But she don come through a very long recovery process but for di past 20 years, she don also get a lot of amazing experiences becos she get a second chance at life wey most pipo wey bin dey on day plane no get.
"One tin I go always carry with me na di loved ones wey dey left behind, I carry with me those pipo wey lose dia loved ones for dat crash, especially di parents of di kids, di 60 angels. Dis na pipo wey despite dia loss, despite dia grief reach out to me, support me and become part of my support system.
Becos of dem, I resolve to live my life as fully and excellently as possible on behalf of those dem lose becos I feel na di least I fit do. Dem dey watch me, pray for me, support me right from day one and all my success na dia success too and na di responsibility I put on myself to make sure say I make dem proud." She tok.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Pastor Bimbo Odukoya of The Fountain of Life church na anoda victim of dat crash. Dis year, her family also do memorial for her and replay some of her old videos of her preaching.
Di church ask pipo to tok wetin dem remember about her.
Legacies wey dat crash bring
Di Loyola Jesuit college community dey hold an annual memorial mass and candlelight procession evri December 10th to remember di "60 Angels".
Out of dat tragedy come di Jesuit Memorial College for Port Harcourt. Di new school dey established on di land donated by di Rivers State govment to di Jesuits as a living memorial, so dat "di lives of oda children fit blossom out of di ashes of dia own children."
A Memorial Hall dey on di Loyola Jesuit College campus, and a statue of an angel with a plaque bearing di names of all sixty students stand as a permanent reminder.
Di crash also prompt significant reforms for di Nigerian civil aviation, including di passing of di Nigerian Civil Aviation Act of 2006 and a ban on aircraft wey dey older dan 22 years.






