Man kill four pikin for Brazil kindergarten attack

Wia dis foto come from, Reuters
At least four pikin dem don die for di hand of one man wey carry axe enta one kindergarten for di city of Blumenau for southern Brazil, local officialstok.
Another four children wunjure for di 25-year-old man hand, we yenta di creche around 9am local time (12:00 GMT) on Wednesday.
Hospital officials say di ones wey injure dey no even reach three years old.
Police tell local tori pipo say di attacker bin surrender and say im dey police custody.
Firefighters say about 40 children bin dey di creche wen di attack happun.
Dem add say di attacker bin jump wall enta di building and just target di victims at random.

Wia dis foto come from, Getty Images
Parents run go di kindergaten as news of di attack spread.
City officials don suspend classes for Blumenau until tomorrow at least.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di govnor of Santa Catarina state – wia Blumenau dey located – don declare three days of mourning.
Dis no be di first time wey dem dey target kindergarten for attack. For 2021, one 18-year-old man kill two staff members and three pikin dem for one creche for di municipality of Saudades.
President Luiz Inácio Lula da Silva tweet say "e no greater pain than dat of family wey loss dia children or grandchildren, even more so wen na through act of violence against innocent children wey no fit defend demsef".













