Rizz na oxford dictionary word of di year - Wetin e mean?

Pesin dey find word for dictionary

Wia dis foto come from, Getty Images

Oxford dictionary don reveal dia word of di year.

Di word of di year for 2023 na rizz, na di Gen Z word for Charisma.

Na YouTuber Kai Cenat make di word rizz dey popular wey tori be say e bin dey use am with im friend.

But di word start to grow more amd more, afta dem use am ask actor Tom Holland which kain rizz im use to gbab im babe, Zendaya.

Oda dictionaries dey also comot with words of di year.

Check some of dem out.

Oxford Dictionary

Oxford dictionary don finally release dia word of di year as rizz.

According to di dictionary, di word mean "na style, charm, or attractiveness, na also di ability to chyke pesin."

According to di Oxford University Press, dem say dis word na im win out of eight words for di running to become di word of di year.

Di shortlist dey chosen from di mood, ethos or preoccupations of di year.

So dis na di word wey bin dey in di running an wetin dem mean.

Swiftie: ogbonge fan of Taylor Swift.

de-influencing: di practice of discouraging pipo to buy particular product or to encourage pipo to reduce how dem dey consume material goods especially through social media.

beige flag: character trait wey show say pesin partner or potential partner dey boring or no get originality, e fit also be habit wey pesin partner or potential partner get wey no dey good or bad.

heat dome: na persistent high pressure weather system ova some place, wey dey trap hot air under am.

prompt: na instruction wey dem dey give artificial intelligence program or algorithm, etc wey dey direct di content e dey make.

parasocial: na type of relationship wey dey one sided, from di view of di fan or follower of popular pesin wey tink say e get deep relationship with di celeb but nothing nothing.

situationship: na romantic or sexual relationship, wey di pipo no confam say dem dey official.

Dem go announce di winning word for December 4.

Merriam-Webster Dictionary

Merriam-Webster Dictionary don release dia word of di year for 2023 and na "authentic".

Di dictionary say di word bin get ogbonge increase in search online dis year.

Dem say di interest, bin come from "tori and tok-tok about AI (artificial intelligence), celebrity culture, identity and social media."

Di word get plenti meaning wey include "not false or imitation" and to dey "true to one's own personality, spirit or character".

Cambridge Dictionary

Di Cambridge Dictionary word of di year na hallucinate.

Hallucinate for here mean wetin dey di artificial intelligence wey dey make am comot with fake informate.

Cambridge Dictionary reveal say with di rise of artificial intelligence, dem don dey add new AI based definitions to words for di dictionary including new terms and how words wey already dey ground get AI based meanings.

Collins English Dictionary

Di Collins Dictionary word of di year for 2023 na AI.

Di dictionary tok say, as pipo dey tink say na di next great technological revolution, AI don see fast growth and don enjoy plenti tok-tok on top im head for 2023.