You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'I wan give my players di opportunity I miss for my football career'
'I wan give my players di opportunity I miss for my football career'
Injury cut short Hyda Ahmad Ghaddar football career and shatter di dreams wey she bin get for dis sport.
But Hyda realise say even if she no fit reach wia she bin dream of, she fit at least help odas to achieve dia own dreams.
Ghaddar tell BBC Pidgin say dis na why she dey train footballers for Kano State, northwest Nigeria.
Ghaddar wey dem born for Lebanon, migrate come Nigeria wit her parents.
She later comot Nigeria to go study and play football before injury stop her.
Story by Abubakar Maccido and Mobolaji Olatunde