OPEC Secretary-General die hours afta visiting Nigeria President

Wia dis foto come from, OPEC
Muhammad Barkindo, di Secretary-general of di Organisation of Petroleum Exporting Countries (Opec), Muhammad Sanusi Barkindo don die.
Mele Kyari, wey be di group managing director of di Nigerian National Petroleum Company (NNPC) Limited, announce di death of Barkindo.
Di OPEC Secretary-General die hours afta visiting Nigeria President, Muhammadu Buhari for Aso Rock on Tuesday.
Kyari make di announcement for im tweet early mor-mor on Wednesday.
OPEC also confam di death of Mohammad Sanusi Barkindo.
E die on 6 July 2022 im home home kontri Nigeria.
OPEC Secretariat say Barkindo passing na big loss to di entire OPEC Family, di oil industry and di international community.
Kyari say Barkindo wey be 63 year die around 11p.m on Tuesday.
End of Di one wey oda users dey read well well
“We lost our esteemed Dr Muhammad Sanusi Barkindo.
“He die at about 11 pm yesterday 5th July 2022. Certainly a great loss to his immediate family, di NNPC, our kontri Nigeria, di OPEC and di global energy community,” Kyari tweet.
E say dem go announce di burial arrangement soon.
Barkindo visit president Buhari

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency
Barkindo die hours afta im meeting wit Nigeria president Muhammadu Buhari for state house.
For di meeting president Buhari describe di Opec Secretary general as “a worthy ambassador of our kontri.”
“We dey proud of your achievements before and during your appointment at OPEC and di proud legacies you go leave behind”, di president media adviser, Femi Adesina for statement quote president Buhari.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Profile of Muhammad Barkindo
Until im death His Excellency, Mohammed Sanusi Barkindo na di current Secretary General of di Organization of the Petroleum Exporting Countries (Opec) for OPEC Secretariat for Vienna, Austria.
Im na graduate of Ahmadu Bello University Zaria wia e get bachelor’s degree in political science den later get postgraduate diploma in petroleum economics and management from di College of Petroleum Studies at Oxford University and master’s degree in business administration from Southeastern University for Washington, DC.
E get im first appointment to di post for a three-year term for Opec 169th Meeting on 2 June 2016 for Vienna.
Dem later re-appoint am for anoda term sake of im leadership.
E take over di leadership of Opec from Abdalla Salem El-Badri wey lead di organization since 1 January 2007 to August 2016
Im na di group managing director of di Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC) from 2009 to 2010.
Before den e serve as deputy managing director of Nigerian Liquefied Natural Gas, a joint venture between NNPC, Shell, Total and Eni.
Also, im bin also serve as di Special Assistant to former Minister of Petroleum Resources and OPEC Secretary-General, HE Dr. Rilwanu Lukman.
Mohammed Sanusi Barkindo don work for different positions for Opec between 1986 and 2010.
For 1986, e get appointment as part of Nigeria delegation to OPEC, and from 1993 to 2008 e serve as Nigeria national representative on Opec economic commission board.
For 2006, e serve as Acting Secretary General of OPEC, and represented Nigeria on OPEC’s Board of Governors from 2009 to 2010.
Barkindo na holder of Honourary Doctorate Degree in Science from Modibbo Adama University and Federal University of Technology, Yola.
Im na fellow member of many international petroleum institutions including di Institute of Petroleum, London.










