Argentina squeeze enta semi-final afta surviving Netherlands scare

Wia dis foto come from, Getty Images
Argentina don become di second kontri to qualify for di semi-final of di Qatar 2022 Fifa World Cup.
Dem go play Croatia wey beat di favourites Brazil for an earlier match.
Croatia win di game via penalty shoot-out 4-2.
Dem go play Argentina for di first semi-final game on Tuesday.
Dis na afta Argentina grind out win over di Netherlands.
Goals from Nolina and dia captain Lionel Messi But Wout Weghorst brace for Netherlands.
Di game later enta extra time without goals from any of di sides.
Na for penalty di game end 4-3 in favour of Argentina.
End of Di one wey oda users dey read well well
Penalty
Netherlands 3-4 Argentina Lionel Messi score for Argentina Steven Berghuis miss for Netherlands Leandro Paredes score for Argentina Teun Koopmeiners score for Netherlands Gonzalo Montiel score for Argentina Wout Weghorst score for Netherlands Enzo Fernandez fail to score for Argentina Lautaro Martinez score di final goal for Argentina
Extra Time
120+1mins: Angel Di Maria play direct to score wey almost beat Andries Noppert.
120mins: Lionel Messi hold di ball for di left side but w no fit convert am. Di pressure much.
118mins: Noa Lang send cross into di box, but Emiliano Martinez catch am.
115mins: A pass land for Lautaro Martinez leg.
113mins: SUBSTITUTION. Noa Lang enta for Cody Gakpo.
113mins: Luuk de Jong control di ball from di resulting free kick inside di six-yard box.
112mins: YELLOW CARD. German Pezzella chop card for challenge.
112mins: SUBSTITUTION. Angel Di Maria enta for Lisandro Martinez .
110mins: Lionel Messi make attempt on goal
105mins: Ref don blow.
104mins: Nicolas Otamendi win di ball from di resulting free kick.
102mins: Direct free kick from promising position. Na Lionel Messi take am
101mins: Jurrien Timber make reckless foul in order to win di ball from im opponent.
100mins: A cross, provided by Steven Berghuis causedno threat to di opposition defence.
98mins: Ref Antonio Mateu Lahoz don give Nicolas Otamendi final warning.
93mins: Rough tackle by Cody Gakpo. Ref blow for foul.
Netherlands 2-2 Argentina
91mins: First half of extra time don start
Second Half

Wia dis foto come from, Getty Images
90+13mins: Ref blow to end di match
Netherlands 2-2 Argentina
90+11mins: GOAL. Wout Weghorst equalize for Netherlands.
90+6mins: Cody Gakpo attempt to find di head of one of im teammates wit promising cross into di box.
90+3mins: Steven Berghuis take di free kick from di edge of di box but di wall block am
90+1mins: German Pezzella give away foul for a violent tackle
90mins: 10 mins of added time.
89mins: YELLOW CARD. Leandro Paredes also chop card
88mins: YELLOW CARD. Steven Berghuis chop card for tackle.
86mins: Steven Berghuis take di corner
85mins: MISSED CHANCELuuk de Jong misse a big chance to equalize.
Netherlands 1-2 Argentina
83mins: GOAL! Wout Weghorst pull one back for Netherlands.
82mins: SUBSTITUTION. Lautaro Martinez enta for Julian Alvarez
81mins: Nicolas Tagliafico delivers low pass into di box.
78mins: SUBSTITUTION. Wout Weghorst enta for Memphis Depay.
78mins: SUBSTITUTION. Nicolas Tagliafico enta for Marcos Acuna. German Pezzella enta for Cristian Gabriel Romero
77mins: PENALTY APPEAL. Cody Gakpo go down inside Argentina 18 but ref say e no follow.
76mins: YELLOW CARD. Lisandro Martinez chop card
76mins: YELLOW CARD. Memphis Depay chop card for rough challenge.
Netherlands 0-2 Argentina
73mins: GOAL! Lionel Messi convert di penalty
71mins: Denzel Dumfries commit ugly challenge. Referee blow for penalty
68mins: Lionel Messi commit rough challenge and ref blow im whistle for a foul.
66mins: SUBSTITUTION. Leandro Paredes enta for Rodrigo de Paul.
64mins: SUBSTITUTION. Luuk de Jong enta for Daley Blind.
63mins: Lionel Messi attempt to threaten di goalkeeper from di free kick on di edge of di box. Di ball go over di crossbar.
61mins: Virgil van Dijk make bad challenge and di ref blow for foul. Argentina get free kick for dangerous position.
59mins: Virgil van Dijk deliver crossfield pass
54mins: Daley Blind attempt to find im teammate wit a pass from outside di box, but di opposition defence dey quick to react and end attack.
51mins: Rodrigo de Paul attempt to pick out a free teammate inside di box, but Andries Noppert come clear di ball away.
49mins: Cody Gakpo swing cross into di box, but e too close to Emiliano Martinez. 48mins: Lionel Messi take di corner kick and send di ball into di penalty area
47mins: Marcos Acuna deliver fine cross into di penalty area, but opposing player clear am comot.
46mins: SUBSTITUTION. Teun Koopmeiners enta for Marten de Roon.
Netherlands 0-1 Argentina
45mins: Second Half don start
First Half
Netherlands 0-1 Argentina
45+7: Ref don blow. First Half don finish.
44mins: YELLOW CARD. Marcos chop card for rough tackle.
43mins: YELLOW CARD. Jurrien Timber chop card.
41mins: Cody Gakpo take di free kick
40mins: Enzo Fernandez commit rough foul.
40mins: Lionel Messi collect low pass inside di box, control di ball and drill am into middle of di goal, but Andries Noppert save am.
37mins: Rodrigo de Paul dey beg for some medical attention wit im painful gestures.
Netherlands 0-1 Argentina
35mins: GOAL! Nahuel Molina score for Argentina. Na Lionel Messi assist
33mins: Rodrigo de Paul attempts to score wit a first-time shot from di edge of di box. Andries Noppert save am.
29mins: Cody Gakpo send a cross into di box, but di opposition defence clear di ball away from danger.
27mins: Lisandro Martinez take short free kick.
26mins: Ref Antonio Mateu Lahoz blow im whistle afta Jurrien Timber commit foul.
24mins: A bold effort from Steven Bergwijn on di edge of di box flies.
22mins: Lionel Messi cut inside afta a good run from di edge of di box.
21mins: Memphis Depay look to break free, but opposing player clear di ball away. Corner to Netherlands.
18mins: Emiliano Martinez display im ability to read di game and clear di danger afta Steven Bergwijn threaten shot from outside di box.
15mins: Gabriel Romero attempts to find one of im teammates, but put am far too much.
13mins: Rodrigo de Paul send good cross into di area, but Andries Noppert intercept di ball.
10mins: A pass by Marcos Acuna ends up out side di lines
9mins: Memphis Depay breaks pass challenges inside di box, but put too much speed on di pass to Cody Gakpo.
6mins: Virgil van Dijk send long ball forward to Cody Gakpo, but e put too much power.
5mins: Rodrigo de Paul take a first-time shot from di edge of di box, but im own player block am.
2mins: Marcos Acuna fails to send pass into di box. Dem cut short im effort.
Netherlands 0-0 Argentina
1min: KICK OFF
Netherlands vs Argentina Line-ups

Wia dis foto come from, Getty Images
Netherlands: Noppert, Timber, Virgyl van Dijk, Aké, Dumfries, de Roon, de Jong, Blind, Gakpo, Depay, Bergwijn
Argentina : Martínez, Molina , Romero, Otamendi, Martínez, Acuña, De Paul, Fernández, Mac Allister, Álvarez, Messi
Team news
Di Netherlands get fully-fit squad to choose from as dem face Argentinafor one repeat of di 2014 World Cup semi-final, wey dem take penalty shootout settle.
Head coach Van Gaal name one unchanged teamfor di last 16 with Depay starting back-to-back games for di first time since September.
Argentina Di Maria don return to training after missing di win over Australia because of a quadriceps issue.
Rodrigo de Paul go dey assessed.
Head to head
- Di 2014 World Cup semi-final na di most recent meeting between di two nations. Argentina triumph 4-2 for one penalty shootout after a goalless 120 minutes. Ron Vlaar and Wesley Sneijder get penalties saved by Sergio Romero. Argentina convert all four penalties, including dia first one by Lionel Messi.
- Di Netherlands fit qualify for di World Cup semi-finals for di fourth time, after 1998, 2010 and 2014. No semi-final stage dey for 1974 and 1978 wen dem reach di final.
- Argentina fit reach di semis of di World Cup for di fifth time, after 1930, 1986, 1990 and 2014. Dem bin win di competition for di first time in 1978 when no semi-finals dey.
- Messi don score 789 goals for 1,000 official games for club and country in all competitions. E score im 1,000th match for di 2-1 win over Australia for di last of 16.











