Wetin to know about Amanda Knox latest trial wey dem convict am for

Wia dis foto come from, Getty Images
One court for Florence don reconvict Amanda Knox for slander, years afta dem clear her of murder of her British roommate Meredith Kercher for 2007.
Knox no go-go prison as she don already serve four years for di murder, wey dem originally convict her for.
Dat time, she bin also chop conviction for slander, sake of say she blame one local bar owner Patrick Lumumba during police interrogation for di murder, but dat conviction dem cancel am last year and order a retrial.
Tori be say Knox lawyers dey plan to appeal against di latest verdict.
Dem add say Amanda bin dey disappointed as she bin dey hope to finally clear her name afta many years of legal battles.
She bin tell di court on Wednesday say police bin put her under pressure to implicate Oga Lumumba.
"Di police bin threaten me wit 30 years for prison, one officer slap me three times and say 'remember, remember'," Knox, 36, bin tok.
"I dey very sorry say I bin no dey strong enough to withstand di pressure from di police," she add, as she speak in Italian.
End of Di one wey oda users dey read well well
"I bin no wan lie about Patrick. Im be my friend, im take care of me and console me for di loss of my friend (Meredith). I dey sorry say I bin no fit resist di pressure and di one wey im suffer."
Oga Lumumba bin chop arrest in connection wit di 2007 murder and im spend two weeks behind bars, but dem release am without charge afta one customer stand for am - give am alibi.
Despite dis, im lawyers say di case affect im reputation, and say dem come “know am everywhere as di monster of Perugia”.
Im lawyer bin tell reporters outside di courthouse before di hearing say: "Im lose im job, dem seize im bar for months, and im bin get to return to Poland, becos im wife na Polish.”
Oga Lumumba bin no dey court.

Wia dis foto come from, PA Media
Di hearing bin happun behind closed doors, and audio and video recording bin no dey allowed.
Knox wey her trial bin get plenty media coverage bin dey convicted and later acquitted for di murder of 21-year-old student Kercher, wey originally come from south London.
Knox and Kercher na language exchange students wey bin dey share one house for di university town of Perugia for 2007.
Dem find Kercher, 21, dead for dia house. Wit her throat cut and she bin dey sexually assaulted too.
Di trial na subject of global media interest becos prosecutors argue say Kercher na victim of a drug-fuelled sex game wey go wrong.
Knox, and her den-boyfriend Raffaele Sollecito, and a third persin wey dem call Rudy Guede chop conviction of murder and sexual violence for December 2009 and jail. Knox bin dey convicted of slandering Oga Lumumba for 2011.

Wia dis foto come from, Getty Images
But dat same year, one jury free Knox and Oga Sollecito on appeal afta doubts begin show ova di forensic evidence dem use against dem, afta dat, Knox return back to US afta she spend four years for prison.
For 2014, dem reinstate di two of dem dia guilty verdicts den ultimately overturn am for 2015.
Knox now dey married wit two young children, and she be campaigner for criminal justice reform. She bin return to Italy five years ago to address one conference on wrongful conviction, wia she bin speak of di pain of being tried by di media.
Di trial na also di subject of one Netflix documentary for 2016, and Knox also publish one memoir about her time forprison.
Oga Sollecito dey leave a quiet life since im release. For 2017, im tell BBC say di case put am inside debt.
Guede – one Perugian resident wey originally bin come from Ivory Coast – bin dey linked to di scene by DNA evidence and na im be di only person wey im conviction for Kercher murder dem uphold. Dem release am for early 2021.
Who be Amanda Knox and wetin happen?
Amanda Knox wey bin serve four years for Italian prison for di murder of her British flatmate Meredith Kercher for Perugia in 2007, bin always insist on her innocence.
For 2011, dem free - acquit her on di basis of DNA evidence but prosecutors successfully appeal and dem bin cancel di acquittal.
For 2014 dem again find her guilty in absentia, after one retrial and dem bin sentence her to 28 years and six months in jail. Di saga bin come to and end wen Italy highest court overturn di convictions of Ms Knox and her former boyfriend, Italian student Raffaele Sollecito for March 2015.
Amanda Knox, wey bin don vow to never willingly return to Italy, say she bin dey "tremendously relieved and grateful" wen di final ruling bin dey announced.
Dem find Meredith Kercher body for her bedroom inside di house she bin dey share with Ms Knox and odas for Perugia, one Italian university town wia di two young women be exchange students.
Dem bin don cut her throat and she bin also dey sexually assaulted.
Prosecutors argue say Ms Kercher na di victim of one drug-fuelled sex game wey go wrong.
Both Ms Knox and Mr Sollecito deny any guilt, say dem bin no even dey di apartment dat night, although dem admit say dem smoke marijuana and say dia memories fit don dey clouded.
Rudy Guede, from Ivory Coast, dey currently serve a 16-year prison sentence for im part for di murder.
For her original trial, Ms Knox say she bin fear to "have di mask of a murderer forced on to my skin".












