Who be Netumbo Nandi-Ndaitwah? Namibia first first female president

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Damian Zane & Danai Nesta Kupemba in London & Frauke Jensen in Windhoek
- Role, BBC News
- Read am in 4 mins
Namibia don elect Netumbo Nandi-Ndaitwah, from di governing South West Africa Pipo Organisation (Swapo) as di kontri first female president afta last week election wey dem dey argue about.
Di electoral commission say she win more dan 57% of di vote, her closest rival Panduleni Itula, get 26%.
Following di logistical problems and di three-day extension for some parts of di kontri, Itula say di electoral process get K-leg.
Im Independent Patriots for Change (IPC) party say dem go challenge di results for court.
Most opposition parties bin boycott di results announcement on Tuesday evening for di capital, Windhoek, di Namibian newspaper report.
Tori be say Windhoek dey calm on Wednesday, no celebrations no protests, pipo just dey carry on wit dia normal lives.
Afta di announcement of her victory, Nandi Ndaitwah say: "Di Namibian nation don vote for peace and stability."
Swapo don dey power for di southern African kontri since independence for 1990.
Who be Netumbo Nandi-Ndaitwah?
Di president elect na 72 years, and di kontri current vice-president,
She join her party as a teenager, many describe her as a loyal party woman, Nandi-Ndaitwah, na trusted leader wey don serve in high goment office for a quarter of a century.
At 14, she become part of di movement wey resist rule from South Africa, wey bin govern di kontri – den wey dem bin dey known as South West Africa – since di end of World War One and later introduce di racist system of apartheid.
Many know her for her determination and organisational talent as leader of Swapo Youth League, wey become a stepping stone for her political career, wey include ministerial roles in foreign affairs, tourism, child welfare and information.
South Africa President Cyril Ramaphosa extend im congratulations to Nandi-Ndaitwah on X on Wednesday.
"Your election as di fifth president of di Republic and di first woman for our region to hold dis high office na testament to democracy and im ability to transform our societies,"im statement read.
Once dey swear her in, she go join di ogbonge club as before now, Tanzania Samia Suluhu Hassan na Africa only female president.
For di parliamentary elections wey bin hold di same time, Swapo narrowly hold on to dia majority, winning 51 out of di 96 elected seats - losing 12. Di IPC win 20 seats, and dem go official be di opposition.
Tirivangani Masawi, political journalist wey dey based in Windhoek, tell BBC Newsday programme say di election na Swapo "worst performance since independence".
Many see Itula, a trained dentist, as more charismatic pass Nandi-Ndaitwah, im manage to affect Swapo popularity for di last presidential election for 2019, reducing dia vote share to 56% from 87% five years earlier.
Di IPC say dem go “pursue justice through di courts” dem tell pipo wey bin no fit vote sake of mismanagement by di electoral commission to go police station to make a statement.
Claus Goldbeck, from di IPC, tell BBC say di voting exercise na "organisational mess".
Some pipo, dem send dem go back dia house afta dem stand for line for 14 hours becos dem bin no get enough ballot papers, and scanners break down for several polling stations.
"Di Electoral Commission of Namibia [ECN] bin get four years to fix tins," e tok.
Di ECN accept di failures in the organisation of di votes and ballot shortages. But di chairperson, Elsie Nghikembua, deny any allegations of fraud.
"I dey beg all Namibians to accept di results wit di spirit of unity, diversity, understanding and reconciliation," she tok.
Swapo bin lead di struggle for nationhood against apartheid South Africa. Ahead of last Wednesday general election, many pipo bin dey tok say dem go suffer di fate of oda liberation parties for di region.
South Africa African National Congress bin lose outright parliamentary majority for May and di Botswana Democratic Party comot for power afta nearly six decades following October election.










