Why Marvel drop Jonathan Majors?

Majors seen leaving court on Monday

Wia dis foto come from, Reuters

    • Author, Max Matza
    • Role, BBC News

Marvel Studios don drop Jonathan Majors afta court convict di Emmy-nominated actor for assaulting im former girlfriend.

On Monday, jury for New York find out say Majors, 34, bin attack and harass British choreographer Grace Jabbari wen dem quarrel for March.

Na afta di verdict, tok-tok pesin for Marvel say di studio no go work wit di actor again.

Majors fit face up to one year for prison wen dem sentence am for February.

Dis go be big downfall for di ogbonge Hollywood actor wey bin dey expected to feature for multiple Marvel feems.

Majors bin play villain Kang di Conqueror for Marvel films. Im act for Ant-Man and di Wasp: Quantumania last February and for Disney+ series Loki, wey now dey di second season.

Marvel don already push back release dates for Avengers: Di Kang Dynasty, wey im dey due to play di starring role. Im bin dey set to perform again as di character for di follow-up film, Avengers: Secret Wars.

E no dey clear whether Marvel Studios plan to replace am wit anoda actor or write im character out of di feems.

According to Di Hollywood Reporter, Marvel don already hire di creator of Loki to re-work a draft of di feem wey bin dey expected to call The Kang Dynasty. Di new working title for di movie na Avengers 5, sources tell di outlet.

Magazine Dreams, one upcoming feem wey Majors act wey many believe to be a possible Oscar contender, dem don postpone di release too sake of im arrest.

Di US Army also drop the Creed III star from one major advertising campaign once di news break.

Im former girlfriend, Madam Jabbari, bin fractured her finger afta di quarrel, and bin get bruises and cut behind her ear afta di couple bin fight ova phone for one car wey dem hire for New York City.

Court sketch of jurors watching CCTV footage of the assault.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Jurors see CCTV footage of di assault

Di incident bin take place wen Madam Jabbari see one text message from anoda woman on Majors phone, wey say: "Wish say I dey kiss you right now."

In an effort to get im phone back, di feem star grab im former-girlfriend, twist her arm behind her back and hit her for her head, Madam Jabbari testify.

Court find am guilty of assault by recklessly causing physical injury, as well as harassment.

However di jury decline to convict am on charges of aggravated harassment and assault wit intent to cause physical harm.

Di prosecution paint di assault as di latest escalation for Majors' attempts to "exert control" ova im girlfriend through physical and emotional violence. Di jury bin see voice recordings and text messages between di former couple.

"I be monster. A horrible man. I no dey capable of love," di actor send am for text for September 2022 while im bin dey threaten to kill imself.

For audio from one argument dat same month, Majors bin tell Madam Jabbari say she need to act more like Coretta Scott King and Michelle Obama, di wives of Martin Luther King and former President Barack Obama.

"I dey do great things, not just for me but for my culture and di world," Im tok, e add say she go need to "make sacrifices" for am.

One statement wey Majors lawyer share afta di actor's conviction say im continue to believe im innocence, "still get faith for di process andI dey look forward to fully clearing imname".

Di Sentencing go happun on 6 February. Di judge also issue a new protection order, wey tell am to no get any contact wit Madam Jabbari.