Laolu Martins dead: Bukka Hut co-owner wey pass away profile

Olaolu Martins

Wia dis foto come from, Olaolu Martins/ LinkedIn

Nigerian restaurant chain, Bukka Hut, announce di death of one of dia founders, Olaolu Martins.

According to di statement, Oga Martins die on Tuesday but dem neva reveal di cause of death.

Na fellow co-founder and current MD/CEO of di company, Rasheed Jaiyeola release di statement on behalf of di company

But who be di man wey follow join create di Bukka Hut brand for 2011.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Who be Olaolu Martins

Olaolu Martins na graduate of di University of Lagos wia im study Business Administration.

Dis information na im we find for Oga Martins LinkedIn page.

E also be Fellow Chartered accountant for Nigerian and Fellow for di Chartered Institute of Stockbrokers as well as di Association of Investment Advisers & Portfolio Managers .

For 2000, e join Stanbic IBTC wia e stay for five years.

For dia e work as Financial Controller and then Head of Asset Management and Head of Stockbroking.

Den e move to Shell Nigeria CPFA for 2005 wia e work as di Head of Investment for three years.

At di time of im death, Martins bin dey work as di Managing Director and CEO of one investment firm wey dem dey call Nigerian International Securities Limited .

E don spend 14 years for di company from 2008.

Dis na im collabo day one with im work for Bhukka Hospitality Ltd wia im bin co-found as well as hold di role of Executive Director.