Liz Truss: UK Prime Minister don resign afta 45 days for office

UK Prime Minister Liz Truss

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, UK Prime Minister Liz Truss don resign

UK Prime Minister Liz Truss don dramatically resign as prime minister afta only 45 days for di job.

Di PM say di pesin wey go take ova from her go dey elected for one Tory leadership contest, wey go dey completed next week.

Tory Members of Parliaments bin encourage Ms Truss to go, afta political kasala scata her goment, and pipo begin dey dump her economic policies.

Her resignation come afta one key minister quit and Tory lawmakers disagree for one messy parliamentary vote.

Na Tory members elect Ms Truss for September, but she lost authority afta series of U-turns.

For one speech outside Downing Street, Ms Truss say: "I know say I no fit deliver di mandate on which dem elect me by di Conservative Party."

Ms Truss say she go remain for post until a successor formally take over as party leader and King Charles III appoint am as prime minister.

Ms Truss - wey enta office 44 days ago - go become di shortest-serving PM for British history when she stand down.

For her speech, Ms Truss say she enta "office at a time of great economic and international instability", as war dey happun for Ukraine and living costs skyrocket.

But her resignation come afta one key minister, former home secretary Suella Braverman, quit and Tory MPs disagree in messy parliamentary vote.

Labour leader Sir Keir Starmer don call for immediate general election afta Ms Truss resignation speech.

Why she resign

Liz Truss dey for office for just 45 days - di shortest tenure of any UK prime minister.

Di second shortest serving PM na George Canning, wey serve for 119 days before e die for office in 1827.

Trouble start for Truss wen her first Chancellor, Kwasi Kwarteng, spook di financial markets wit im mini-budget on 23 September.

Since then, Conservative disquiet don turn into into widespread anger within di parliamentary party.

Her stepping down today follow dramatic scenes for di House of Commons last night ova one vote on fracking.

Truss premiership don dey for turmoil since her mini-budget last month, scata markets. New Chancellor Jeremy Hunt later scrap am.

However, di prime minister say her goment deliver on providing support for energy bills and reverse a rise in National Insurance, tax on workers and companies.

But Ms Truss resignation dey come afta a period of political and economic turbulence, wey force her goment to ditch tax cuts wey bring down di financial markets.

Di prime minister sack close political ally Kwasi Kwarteng as chancellor and appoint Jeremy Hunt as his successor as she attempt to calm di markets.

At Prime Minister Questions on Wednesday, Ms Truss insist say she be "fighter, not a quitter" afta Labour leader Sir Keir Starmer ask her why she neva resign.

But more instability follow when Suella Braverman quit as home secretary and a vote on fracking fell into disarray, wit some Tory MPs accused of bullying.

Liz Truss six weeks in office timeline

UK Prime Minister Liz Truss resign
Wetin we call dis foto, UK Prime Minister Liz Truss resign