Queen Elizabeth II don die

Queen Elizabeth II dead: King Charles III of England ascend throne - HM Queen Elizabeth II
Wetin we call dis foto, HM Queen Elizabeth II

Queen Elizabeth II, di UK longest-serving monarch, don die for Balmoral at di age of 96, afta she reign for 70 years.

She die peacefully on Thursday afternoon for her Scottish estate, wia she bin don spend most of di summer.

Di Queen climb di throne for 1952 and witness plenti social change.

Her son King Charles III say di death of im beloved mother na one "moment of great sadness" for am and im family and dat her loss go dey "deeply felt" around di world.

Her family gather for her Scottish estate after concerns grow about her health earlier on Thursday.

King Charles say: "We mourn profoundly di passing of one cherished sovereign and a much-loved mother.

"I know her loss go dey deeply felt throughout di country, di realms and di Commonwealth, and by countless pipo around di world."

go lead di kontri in mourning as di new King and head of state for 14 Commonwealth realms. Camilla, im wife, become Queen Consort.

During di coming period, e say e and im family go dey "comforted and sustained by our knowledge of di respect and deep affection wey di Queen so widely held".

Inside one statement, Buckingham Palace say: "Di Queen die peacefully at Balmoral dis afternoon.

Di King and im wife, Camilla, now Queen Consort go return to London on Friday, Buckingham Palace tok.

All di Queen's pikin travel to Balmoral, near Aberdeen, after doctors place di Queen under medical supervision.

Her grandson, Prince William now heir to di throne, also dey dia, wit im brother, Prince Harry, on im way.

Prime Minister Liz Truss, wey di Queen appointed on Tuesday, say di monarch na di rock on which modern Britain dey built, wey don"provide us with di stability and strength wey we need".

Speaking about di new King, she tok: "We offer am our loyalty and devotion, just as im mother devoted so much, to so many, for so long.

"And with di passing of di second Elizabethan age, we usher in one new era for di magnificent history of our great kontri, exactly as Her Majesty for don wish, by saying di words 'God save di King'."

Queen Elizabeth II tenure as head of state span post-war austerity, di transition from empire to Commonwealth, di end of di Cold War and di UK entry into - and withdrawal from - di European Union.

Her reign span 15 prime ministers starting with Winston Churchill, born in 1874, and including Ms Truss, born 101 years later in 1975.

She hold weekly audiences with her prime minister throughout her reign.

For Buckingham Palace in London, crowds wey dey wait updates on di Queen condition begin dey cry as dem hear of her death. Di Union flag on top of di palace dey lowered to half-mast at 18:30 BST and dem post one official notice announcing death outside.

Queen Elizabeth II dead: King Charles III of England ascend throne - Buckingham Palace staff place the official notice of the Queen's death outside the palace

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di official notice read: "Di Queen die peacefully at Balmoral dis afternoon. Di King and Queen Consort go remain at Balmoral dis evening and go return to London tomorrow."

On di Queen death, Prince William and im wife, Catherine, become di Duke and Duchess of Cambridge and Cornwall.

Dem born di Queen Elizabeth Alexandra Mary Windsor, for Mayfair, London, on 21 April 1926.

Only some pipo fit don see say she go become Queen but for December 1936, her uncle, Edward VIII, komot from di throne to marry one American woman wey don divorce two times, Wallis Simpson.

Elizabeth father become King George VI and, at age 10, Lilibet, as she dey known for di family, become heir to di throne.

Within three years, Britain dey at war wit Nazi Germany. Elizabeth and her younger sister, Princess Margaret, spend much of wartime for Windsor Castle after dia parents reject suggestions make dem evacuate to Canada.

After turning 18, Elizabeth spent five months with di Auxiliary Territorial Service and learn basic motor mechanic and driving skills. "I begin to understand di esprit de corps wey flourish in di face of adversity," she recall later.

Through di war, she exchanged letters wit her third cousin, Philip, Prince of Greece, who dey serve in di Royal Navy. Dia romance blossom and di couple marry for Westminster Abbey on 20 November 1947, with di prince taking di itle of Duke of Edinburgh.

She go later describe am as "my strength and stay" through 74 years of marriage, before im death in 2021, aged 99.

Queen Elizabeth II dead: King Charles III of England ascend throne -To mark their Diamond Wedding Anniversary on 20 November 2007, the Queen and Prince Philip re-visit Broadlands where 60 years ago in November 1947 they spent their wedding night

Wia dis foto come from, Tim Graham/PA

Wetin we call dis foto, Di Duke of Edinburgh at di Queen's side for more dan six decades of reign, becoming di longest-serving consort in British history in 2009

Dem born dia first son, Charles, in 1948, followed by Princess Anne, in 1950, Prince Andrew, in 1960, and Prince Edward, in 1964. Between dem, dem give dia parents eight grandchildren and 12 great-grandchildren.

Princess Elizabeth dey Kenya for 1952, dey represent di ailing King, wen Philip break di news say her father don die. She immediately return to London as di new Queen.

"All na very sudden kind of taking on and making di best job you can," she later recall.

Dem crown Elizabeth for Westminster Abbey on 2 June 1953, aged 27, in front of then-record TV audience estimated at more dan 20 million pipo.

Subsequent decade go see great change, with di end of di British Empire overseas and di swinging '60s sweeping away social norms at home.

Elizabeth reform di monarchy for dis less deferential age, engaging with di public through walkabouts, royal visits and attendance at public events. Her commitment to di Commonwealth na constant - she visit every Commonwealth kontri at least once.

But periods of private and public pain dey. In 1992, di Queen "annus horribilis", fire devastate Windsor Castle - one private residence as well as working palace - and three of her children's marriages break down.

After di death of Diana, Princess of Wales, for one car accident for Paris in 1997, di Queen draw criticism say she appear reluctant and no respond publicly.

Questions dey about di monarchy relevance in modern society.

"No institution… suppose expect to dey free from di scrutiny of pipo wey give am dia loyalty and support, not to mention pipo wey no give dia support," she acknowledge am.

Queen Elizabeth II dead: King Charles III of England ascend throne - Duke and Duchess of York wit dia eldest baby daughter Princess Elizabeth at her christening

Wia dis foto come from, PA

Wetin we call dis foto, Dem born Elizabeth Alexandra Mary Windsor for Mayfair, London, on 21 April 1926, di first child of di Duke and Duchess of York

As a 21-year-old princess, Elizabeth don vow to devote her life to service.

Reflecting on those words decades later, during her Silver Jubilee for 1977, she declare: "Although I make dat vow for my salad days, wen I dey green in judgment, I no regret or retract one word from am."

She make dat same commitment to serve 45 years later for one thank you letter to di nation on di weekend of her Platinum Jubilee for June.

Dem celebrate di milestone wit a mix of state ceremonies and one colourful festival of all things British, plus lively street parties.

Although di Queen health keep her from some events, she tok say: "My heart don dey wit you all."

For one moment wey dem meet wit cheers from huge crowds for di Mall, three generations of her family join her on di Buckingham Palace balcony for di finale of one pageant.

King Charles, aged 73, become head of state for 14 Commonwealth realms.

Im and im wife, Camilla, dey for Balmoral alongside im siblings, Princess Anne, and Princes Andrew and Edward.

Edward wife, Sophie also accompany dem by, plus Princes William and Harry.

William wife, Catherine, remain for Windsor wit dia children - George, Charlotte and Louis - as e don be dia first full day for one new school.

Di Royal Family now don enta a period of mourning.

Dem go cancel official engagements and Union flags go fly at half-mast on royal residences, government buildings, across di Armed Forces and UK posts overseas.

Foreign leaders don pay tribute to di Queen, wit US President Joe Biden dey remember how she stand in solidarity wit di US in dia "darkest days" afta di 9/11 terrorist attacks.

To France president, Emmanuel Macron, she be "kind-hearted Queen" and "friend of France".

For Justin Trudeau, Canada prime minister, di Queen na constant for Canadians' lives and one of im "favourite pipo for di world".

Chinese President Xi Jinping say: "Her passing na great loss to di British pipo."

Indian Prime Minister Narendra Modi recall im "memorable meetings" wit di monarch during two UK visits. "I no go ever forget her warmth and kindness," im tweet am.

Ukraine President Volodymyr Zelensky tweet say na wit "deep sadness" im learn of "dis irreparable loss".

And Russian leader Vladimir Putin send im "deepest condolences" to King Charles III.