Big Brother Naija 2022 housemates: Ex-Miss Nigeria, pharmacist, hype-woman, meet di BBNaija level-up housemates

Big Brother Naija housemates

Wia dis foto come from, BBN

Read am in 5 mins

Di bell ring and you go know say na dat time of di year wen most young pipo go dey stuck to dia televisions and mobile devices for over 70 days watching as oda young pipo dey participate for di season 7 of di Big Brother Naija reality show.

Di housemates dey compete for a grand prize of N100M and perhaps dis na why di show dey always create so much buzz year in year out.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Over di years, many Nigerians don criticise di show and many continue to see di show as "distraction" and something wey no dey add value to di society.

In 2019, one Islamic human rights organisation, di Muslim Rights Concern, Muric bin ask di Federal goment of Nigeria to ban di show.

Muric Director, Prof. Ishaq Akintola bin describe di show as ''abomination'', ''exhibition of nudity'' and ''invitation to chaos and insecurity'' becos e dey allegedly mislead di young pipo.

Fans of di show most times no dey mind wetin oda pipo dey tok about am as di show dey always carry on despite di condemnation.

Dis time around and wit di 2023 general election for Nigeria around di corner, pipo dey caution di young pipo, make dem no allow di show distract dem.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

E dey debatable weda or not di show don 'distract' anybody as some believe but young pipo wey don appear for di reality TV show don also see am as opportunity to live dia dream.

Especially for Nigeria wey di number of unemployed youths dey high.

Di seventh edition of di show wey dem tag ''Level Up'' return wit im first-12 housemates on Saturday and fans dey expect di remaining housemates on Sunday evening.

Like evri season critics don begin chook mouth about di show while fans don already begin dey choose dia faves.

Dis na all di 24 housemates wey don enta di house;

BBNaija Season 7 Housemates

Ex-miss Nigeria, Beauty Etsanyi Tukura na 24-years-old lawyer from Taraba state.

She tell her oda housemates say she dey passionate about advocacy.

Beauty

Wia dis foto come from, BBN

Wetin we call dis foto, Beauty

Groovy na 26-years-old fashion entrepreneur and model from Anambra state.

Groovy

Wia dis foto come from, BBN

Wetin we call dis foto, Groovy

Ilebaye Odiniya, 21, na graduate of criminology and security studies.

Ilebaye

Wia dis foto come from, BBN

Wetin we call dis foto, Ilebaye

22-years-old Daniella Peters na poet who also dey act.

Daniella

Wia dis foto come from, BBN

Wetin we call dis foto, Daniella

Cyph real name na Bright Hidi Nwekete. Im na Electrical Engineering graduate from Imo state.

Cyph

Wia dis foto come from, BBN

Wetin we call dis foto, Cyph

Saviour Ikin Akpan aka Pharmsavi na licensed pharmacist from Akwa Ibom state.

Pharmsavi

Wia dis foto come from, BBN

Wetin we call dis foto, Pharmsavi

Phyna wey her real name na Ijeoma Josephine Otabor na edo-state born actress, She say she dey also dey do hype-woman for clubs.

Pyna

Wia dis foto come from, BBN

Wetin we call dis foto, Pyna

Keseina Tony Adjekpovu alias Kess fit be one of di oldest housemates dis season. Di 28-years-old businessman say im wife bin don give am permission to participate actively for di show.

Kess

Wia dis foto come from, BBN

Wetin we call dis foto, Kess

Chiamaka Crystal Mbah aka Amaka na 23-years-old Anambra state born health care worker.

Amaka

Wia dis foto come from, BBN

Wetin we call dis foto, Amaka

Khalid Ismail Ahalu na 22-years-old university undergraduate wey enjoy archery, skateboarding and basketball among oda tins.

Khalid

Wia dis foto come from, BBN

Wetin we call dis foto, Khalid

22-years-old Brian Chkuwuebuka Chiji aka Bryann na singer and songwriter.

Bryann

Wia dis foto come from, BBN

Wetin we call dis foto, Bryann

Christiana Oluwafunke Ojumu alias Christy O na 24-years-old beauty entrepreneur from Ondo state, southwest, Nigeria.

Christy O

Wia dis foto come from, BBN

Wetin we call dis foto, Christy O

Meet Sheggz. Im na professional footballer and "lover of Goosebumps."

Sheggz

Wia dis foto come from, dstvnigeria/Instagram

Shey you like to dance? Chi Chi na your girl. She be exotic dancer.

Chi Chi

Wia dis foto come from, dstvnigeria/Instagram

Oya meet Hermes, e call imsef "proud boyfriend of two."

Hermes

Wia dis foto come from, dstvnigeria/Instagram

Meet Diana! Just check her out.

Diana

Wia dis foto come from, dstvnigeria/Instagram

Giddyfia na di latest housemate to enta di BBNaija season 7 house. Im say im dey here for di game and also, e no go mind carry any girl wey catch im eyes for di house dey go.

Giddyfia

Wia dis foto come from, dstvnigeria/Instagram

Chomzy na di next to enta house. She say na di money carry her come. N100m!

Chomzy

Wia dis foto come from, dstvnigeria/Instagram

And here na Dotun. Dotun plan to make di house catch fire. im promise to you be say, "im go bring a lot of hotness!"

Dotun

Wia dis foto come from, dstvnigeria/Instagram

Meet Allysyn! She dey excited to come Big Brother Naija Season 7 and she dey curious!

Allysyn

Wia dis foto come from, dstvnigeria/Instagram

Here come Adekunle. Adekunle na Lasgidi man and im carry Lagos swags plus wahala come you land your domot for di next 70 days.

Adekunle

Wia dis foto come from, dstvnigeria/Instagram

Doyin na smart multitasker. Watch out for her, she ready to give gbas gbos wen e necessary.

Doyin

Wia dis foto come from, dstvnigeria/Instagram

Meet Eloswag, im na dancer and im dey single, ready to mingle, but im no ready for relationship o!

Eloswag

Wia dis foto come from, dstvnigeria/Instagram

Dis na Bella! She like her space even as she come compete for di big prize of N100m

Bella BBN season 7

Wia dis foto come from, dstvnigeria/Instagram

Di organizer of di show over di years don describe as not only entertaining but also educating.

BBNaija past winners

Five boys plus one girl

Wia dis foto come from, Other

Season 1 Katung Aduwak

Season 2 Efe Ejeba

Season 3 Miracle Igbokwe

Season 4 Mercy Eke

Season 5 Olamilekan Agbeleshe

Season 6 Hazel Oyeze Onou