Russia and Ukraine war 2022: Fighting don start for Ukraine second city Kharkiv

Wetin we call dis Video, WATCH: Ukrainian troops street fighting in Kharkiv
    • Author, George Bowden & Viktoriia Zhuhan
    • Role, BBC News

Ukrainian forces say dem don push back di attack for di second city Kharkiv, afta dem clash wit Russian forces.

Regional govnor Oleh Sinegubov say di city don dey free from Russian troops afta street to street fighting for through out di night.

Pipo wey dey stay for dia describe serious shelling, one woman describe say " e be like Star Wars on top of your head"

According to emergency services, shellings hit one Nine- storey building wia pipo dey live.

Di building dey seriously damaged and one elderly woman die, emergency services tok.

Rescuers tok say about 60 pipo dey safe sake of say dem go hide for di basement(underground).

" I no fit describe di sounds wey wake me up one Kharkiv resident tok about di fight wey happun overnight.

Anoda resident, University Professor Dmitry Shabanov say im family dey fortunate to still get running water.

" We call our friend to join us she get newborn baby and anoda small pikin. But she no fit take di risk to come meet us hia . E tok

Russian troops don also blow up one natural gas pipeline nearby according Ukrainian state agency.

Di fighting for Ukraine don cause at least 240 civilian casualties and 64 pipo don die, na so di Office of di United Nations High Commissioner for Human Rights tok.

E add say houses and critical infrastructure wey don spoil don keep plenti pipo for darkness as light and water no dey.

Map showing whole country. Updated 27 Feb

Di BBc don verify one video for di elegram messaging platform wey show how Russian trucks dey drive enta into Kharkiv.

Anoda video wey dey verified by di BBC show one group of Ukrainian soldiers taking cover behind a wall, while one launched a shoulder-fired missile.

E dey comes after an oil terminal outside di capital Kyiv dey attacked by missile, prompting toxic air warnings.

Di massive explosion for Vasylkiv, 18 miles (30km) south of Kyiv, see flames light up di night sky.

Dos wey dey nearby dey warned to close dia windows - though many for Kyiv don already dey take shelter underground.

Strict curfew for di capital dey in place until Monday.

2px presentational grey line

In oda developments as di Russian invasion don almost reach di end of im fourth day:

  • Russian President Vladimir Putin don put di kontri's nuclear weapons on special alert, prompting condemnation by di US
  • Ukraine's President Volodymyr Zelensky tok say e dey willing to send delegation to di Ukrainian-Belarusian border for toks with di Russians without preconditions
  • Thousands more Ukrainians waka towards neighbouring kontris to escape di war, with UN estimating say refugee numbers don reached 368,000 and still dey rise.
  • Russia's central bank don brace for economic turmoil afta di EU, US and dia allies announce di harshest financial measures imposed on Russia to date
  • Russian airliners turned round for mid-air as dozens of European nations ban flights from di country amid rising pressure on Moscow
  • Sweden don announce say dem go send military and oda aid to Ukraine
  • Russia acknowledge losses for di first time but dem no tok number of casualty
2px presentational grey line

Russia attack Ukraine: More tori

line