Abba Kyari arrested: Police hand over DCP, others dem arrest to NDLEA ontop accuse say dem belong to one drug cartel

Wia dis foto come from, Abba Kyari
Di National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA don confam say police don arrest di suspended DCP Abba Kyari wey dem bin declare wanted ontop accuse say e belong to drug cartel and hand am over to dem.
Dis na afta NDLEA bin declare on Monday, 14 February for press briefing say, di former Commander of Intelligence Response Team (IRT) na member of one drug cartel wey dey operate di Brazil-Ethiopia-Nigeria illicit drug pipeline.
"Five of di wanted suspects namely DCP Abba Kyari, ACP Sunday J Ubua, ASP Bawa James, Inspector Simon Agirgba and Inspector John Nuhu na im police drive come di national headquarters of di NDLEA around 5pm, on Monday, 14 February, to formally hand dem over for interrogation and further investigation." Na so di statement from NDLEA tok,
Di NDLEA confirmation come just hours afta police bin confam give BBC Pidgin say dem arrest Kyari and di four odas wey dem indict for di mata and dem bin dey dia custody.
Earlier on, NDLEA bin tell tori pipo say Kyari failure to cooperate na im make dem come out for public to declare am wanted.
"Unfortunately, some law enforcement agents wey suppose be partners for di pursuit of di president mandate dey front of breaking di law, as dem dey aid and abet drug trafficking for di kontri.
Today, we dey forced to declare one of such law enforcement agents wanted in di pesin of suspended DCP Abba Kyari, di former Commander of Intelligence Response Team (IRT) for di Force Intelligence Bureau of di Nigerian Police Force.
With di intelligence wey dey our hand, di Agency believe strongly say DCP Kyari na member of drug cartel wey dey operate di Brazil-Ethiopia-Nigeria illicit drug pipeline, and e need to ansa questions weycrop up in one ongoing drug case wey e be principal actor. " NDLEA bin tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
NDLEA tok how e hapun
NDLEA allege say di mata start on Friday, January 21, 2022, wen DCP Kyari make call to one of di NDLEA officers for Abuja for 2:12 pm. Wen di officer return di call two minutes later, Kyari inform am say e dey come to see am to discuss one operational mata afta Juma'at service.
"E show for di agreed venue of di meeting with di officer and go straight to di koko of di mata.
Na like dis: Im team bin gbab and arrest some traffickers wey come into di kontri from Ethiopia with, according to am, 25kg of cocaine.
E propose a drug deal wia im and im team go take 15kg of di cocaine and leave 10kg for di prosecution of di suspects wey dem arrest with di illicit drug for Enugu. In di meantime, di cocaine wey dey dia hand go dey replaced wit fake one wey worth 15kg. E askdi NDLEA officer to ask im men for di FCT Command, to play along too." NDLEA allege.

Wia dis foto come from, InSTAGRAM
Abba Kyari - Hushpuppi palava
Di Nigeria Police Service Commission (PSC) on Friday give police two weeks to conclude further investigation ontop di case wey involve Abba Kyari and Hushpuppi aka Ramon Abbas, wey dey face accuse of fraud.
Earlier on, one special panel wey di Inspector General of Police set up bin don investigate Kyari ontop di mata.
Dem bin forward di report to di Attorney General of di Federation and Minister of Justice for legal advice.
Di commission dis time direct say di investigation go take half di time e bin take di police to conduct di original one. Dem also add say make dis one dey carried out by a different panel.
Oga Kyari bin chop suspension on top accuse say e dey involved inside one $1.1 million internet fraud wey Instagram influencer, Hushpuppi and four odas allegedly carry out.
Di Federal Bureau of Investigation (FBI) bin allege say Hushpuppi pay $20,600 to two bank accounts wey Kyari allegedly provide on January 20,2020.
Kyari, until di commission suspend am na di officer-in-charge of di Inspector-General of Police Intelligence Response Team.
Nigeria police begin investigation on Abba Kyari afta allegation and indictment from US Federal Bureau of Investigation over allegations say e get link with Instagram influencer and fraudster, Hushpuppi.
US officials say Hushpuppi allege for one affidavit say e make Abba Kyari to arrest one syndicate member wey e get quanta with.
Di report say, den Abba Kyari allegedly send Hushpuppi details of one bank account wey e fit deposit payment for di arrest.
But Abba Kyari don deny any involvement with Hushpuppi. E later receive suspension from work until di outcome of di investigations on top di accuse.

Wia dis foto come from, Abba Kyari/Instagram
Who be Abba Kyari?
DCP Abba Kyari na from di Kanuri tribe for Borno state for northeast Nigeria. Dem born am for March 17, 1975.
Oga Abba Kyari na graduate of Geography wey join di Nigeria Police Force as cadet Assistant Superintendent of Police for 2000 afta e complete im training for Police Academy, Wudil, Kano state.
One of di operations wey make Kyari blow, na wen im lead di arrest of one notorious armed robber wey dem dey call 'Ndagi' a.k.a Spirit.
Spirit bin colobi Numan, di number three biggest town for Adamawa state northeast Nigeria. Im bin hold di town hostage for many years before dem eventually catch am.
For 2005, im join di Mobile Police Force and for 2010 dem post am go Lagos Command.
Kyari become di number two man and officer-in-charge for di Special Anti-Robbery Squad (Sars) - di squad wey dey fight violent crimes from armed robbery, car theft, kidnapping, gang clashes, sea piracy and terrorism but wey later become notorious for im brutality wey lead to di October 2020 Endsars protest. Im serve Sars for five years.
As intelligence officer, im don receive many accolades both local and international for im successful crime busting rates.













