JAMB Registration 2022: Jamb postpone registration date- see wen e go happun now

Wia dis foto come from, Getty Images
Joint Admissions and Matriculation Board JAMB don postponed di registration date for Unified Tertiary Matriculation and Direct Entry for one week.
Di registration exercise wey suppose start on Saturday, 12th February, 2022, go start from 19th February, 2022 to 26th March, 2022
Tok-tok pesin Dr. Fabian Benjamin for statement tok say di one-week postponement na to give dem enough time to fine-tune di upgraded and more user-friendly procedures wey candidates go take register.
E add say dem go conclude di process, within di one-week extension period.
E go also give dem time to get feedbacks from all stakeholders.
JAMB say di new and improved procedures for di 2022 UTME Registration go dey available for dia weekly bulletin for dia website on Monday February 14, 2022
Jamb introduce self-registration for candidates
Joint Admissions and Matriculation Board Jamb say dem wan introduce registration centres for Lagos and Abuja wia candidates wey sabi use computer well well fit register for di exam by demsef.
Dis self-registration na for di 2022 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) and Direct Entry (DE) examination dem.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Joint Admissions and Matriculation Board announce dis new development for dia weekly bulletin wey dem publish on Monday for dia website.
Tok tok pesin Dr Fabian Benjamin for di publication say di reason why dem wan do dis self registration na to utilise di digital competence wey di candidates get and to also reduce di crowd and make am easy for candidates to register for di exam.
"Why we consider dis noble idea na to, besides oda tin dem advance digital competence of candidates wey feel say dem fit do di registration by demsef, expand di registration access point dem in line wit di Covid-19 protocol"
"Di pipo wey go provide di service, Bankfort dey hopeful about di potential of di registration mode wey no go give dem plenti wahala, na wetin dey happun for developed climes"
How you fit register by yourself
Di board announce say dem don adopt '66019' as additional and optional USSD code apart from di '55019' code wey dem don dey use since 2018 for di UTME and DE registration and oda essential services.
E explain say di idea na to facilitate di 2022 UTME and DE registration so dat complain no go dey.
E go also make sure say pipo no find am difficult to create dia profiles, especially as plenti pipo go send request wit one USSD code.
"As usual, candidates go send dia National Identity Number (NIN) through any of dis USSD Codes for dia details to come from National Identity Management Commission database.
Afta dat dem go proceed to any accredited centre for biometric capturing.
Di board also tok say dem dey perfect arrangements to get anoda USSD Code so dat dem go remove any tin wey dey cause obstruction to create profiles.





!["Today Jamb question and answer":[How many days does jamb result come out]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/15FAD/production/_118992009_todayjambquestionandanswer-howmanydaysdoesjambresultcomeout.jpg.webp)






