Tunisia Prime Minister sacked by kontri President over Covid riots

Wia dis foto come from, Getty Images
Tunisia dey face dia biggest democracy crises inside ten years on Monday afta di president sack di prime minister plus suspend parliament afta violent mass protests all over di kontri on Sunday.
Tunisia pipo dey protest for many tins especially anger sake of how di goment dey take handle di current increase in Covid-19 cases plus di economic and social palava wey di kontri dey face.
President Kais Saied decision to sack im cabinet members dey enjoy di support of di army but some groups including opponents for parliament and influential Islamic ones say im action na coup.
Oga Saied, wey bin enta office for 2019 as independent politician bin announce say im dey take over afta im remove Prime Minister Hichem Mechichi, wey be member of di biggest party for parliament.
President fit remove Prime Minister?
One of di biggest challenge wey dey face di Tunisia 2014 constitution na di division of power among di president, prime minister and parliament.
Di president and di parliament all enta office through separate popular votes for 2019, while oga Mechichi become prime minister last summer as im replace di goment wey bin dey before.
President Saied say im sacking of im PM and some of di members of parliament na based on Article 80 of di Constitution.
Under di constitution, di president direct responsibility na only on foreign affairs and di military, but afta goment kasala wit Covid walk-in vaccination last week, im order di take over and remain in charge of di pandemic response.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wetin bin happun?
On Sunday, thousands of protesters for different parts of Tunisia enta road do i-no-go-gree against di prime minister and di Ennahda party.
Some of di protesters enta di Ennahda office dem destroy tins plus burn one of dia local headquarters.
One protester tell tori pipo Reuters say dis na "di happiest moment since di revolution [for 2011]."
Anoda one tell tori pipo Agence France-Presse say di president don "show imsef as true leader," but one oda protesters say: "Dis fools dey celebrate say dem don born new dictator."
Protesters no allow some members of parliaments enta di legislature on Monday.














