Aisha Alhassan "Mama Taraba" dead: Buhari former Minister of Women Affairs don die

Aisha Alhassan "Mama Taraba" dies: [Buhari former 'Minister' of Women Affairs don die]

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Hajiya Aisha Alhassan wey dey popular as "Mama Taraba" die at di age of 61.

Aisha Jummai Alhassa, Nigeria former Minister of Women Affairs AKA Mama Taraba don die

Hajiya Alhassan pass away for hospital for Cairo wey be capital of Egypt on Friday due to undisclosed illness.

Her sister confam tori of di death to BBC but no give additional information about cause of death.

Aisha Alhassan "Mama Taraba" dies: [Buhari former 'Minister' of Women Affairs don die]

Wia dis foto come from, @SenAishaAlhassn

Wetin we call dis foto, Mama Taraba bin buy APC form to contest but dem disqualify am

Hajiya Alhassan serve as women affairs minister under president Muhammadu Buhari administration from 2015-2018.

She resign to go contest govnorship election for her home state of Taraba for northern Nigeria.

Before then she bin also dey Senate between 2011- 2015 as one of di only four women wey dey senate dat time.

Aisha Alhassan "Mama Taraba" dies: [Buhari former 'Minister' of Women Affairs don die]

Wia dis foto come from, Senator Jummai Alhassan

Wetin we call dis foto, Mama Taraba tell president Buhari bye-bye, 'I no work again'

After di female politician leave goment for 2018 she decamp from di ruling APC.

She contest 2019 govnorship under UDP before she lose to present Taraba govnor Darius Ishaku of PDP.

Mama Taraba death make many Nigerian leaders sad wen di news break on Friday evening.

Govnor Darius Ishaku and President Muhammadu Muhari her former boss, dey among those wey express sadness.

Aisha Alhassan "Mama Taraba" dies: [Buhari former 'Minister' of Women Affairs don die]

Wia dis foto come from, Screenshot