Imo state news: Ehime Mbano police HQ come under attack a day afta Owerri prison break - See wetin we know

Ehime Mbano Police HQ wey gunmen attack
Read am in 2 mins

Some gunmen on Tuesday attack di Area Divisional Police Headquarters wey dey Ehime Mbano local goment area of Imo state.

Dis dey come a day afta dem carry out similar attack for di state police heaquarters and di prison wey dey Owerri, di state capital and hours afta Vice President Yemi Osinbajo comot di state afta im visit.

Di toktok pesin for di state police command wey confam di attack say no police officer die for di incident but di gunmen burn three vehicles.

Channels TV dey report di gunmen, wey come in buses and in a large number, free all di suspects in detention before set di building on fire.

For one video wey one Facebook user post, pipo of di community bin dey try to put out di fire wit bucket of water.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Picture of police station gunmen burn for Owerri attack

Wia dis foto come from, Imo state government

Wetin we call dis foto, Picture of police station gunmen burn for Owerri attack

''We still dey hear gunshot'' Witness

For interview wit BBC pidgin , an indigene of di community Ehime-Uboma at about 7:20pm say true true di kasala happun.

Di eyewitness tok say, "I no know how many di boys dey but dem first begin shoot wey make everybody run before dem enter di police station.

" As I dey talk to you know we still dey hear gunshots. E be like sey security pipo don come to pursue dem.

Everybody dey hide for im house.' she tok.

More pictures from Ehime Mbano:

Ehime Mbano police station
Ehime Mbano Police HQ wey gunmen attack
Ehime Mbano Police HQ wey gunmen attack