Latest Nigeria news on [Kagara abduction] Niger State: Ahmad Gumi meet bandits, want 'blanket amnesty' afta students abduction

[Kagara abduction]

Wia dis foto come from, Other

Kaduna based Islamic Scholar, Sheik Ahmad Gumi don ask di Federal Government to give blanket amnesty alias forgiveness to armed bandits and herdsmen wey dey cause kasala nowadays like dem do for Niger Delta militants before-before.

Sheik Gumi give di recommendation as e dey yarn wit tori pipo for Niger state government house, Minna on Friday Morning after a closed door meeting with Governor, Abubakar Sani Bello.

Gumi say if dem give di bandits amnesty and if any of dem kontinu, den dem go punish di pesin.

Gumi say him dey on a mission to see say Nigeria get peace and dat e also listen to di bandits to know wetin dey chook dem for liver so dat dem go find solution to di security kata-kata wey di happun for di kontri

E say I'm journey inside bush to meet wit di bandits dey successful and dem be two faction and each of dem get dia own complain.

He also say e get positive response from di bandits dem wey di terrorize Niger state.

Kagara Niger State Nigeria

Wia dis foto come from, Other

On top di students abduction for Kagara Niger State Nigeria, one popular Islamic cleric Sheik Ahmad Gumi don tell BBC Pidgin say him don meet some bandits regarding di Government Science College students and staff wey dey abductors hand.

Dem promise am say dem go helep see to di release of di students Sheik Gumi tok on Friday morning.

Sheik Gumi say unlike wetin some media report, no be di Kagara abductors im meet but oda ones wey get links to dem and dem say dem know dem.

"Na true say I hold meeting wit some pipo regarding di Kagara students abduction and dem tell me say even though no be dem do am but dem know di pipo wey kidnap di students and dem go do dia best for di mata."

"And dem tell me say dem go see say di Kagara pipo dey released anytime from now." Dis na wetin Sheik Gumi yan.

Kagara Niger State Nigeria: Gumi

Wia dis foto come from, FACEBOOK / DR AHMAD GUMI

Wetin we call dis foto, Sheik Ahmad Gumi

Di medical doctor turned cleric bin enter Niger state on Wednesday on di invitation of di state goment after di kidnapping.

After meeting with Govnor Abubakar Sani Bello, im and Secretary to State government Ahmed Matane enter Minna forest to go meet some bandits.

For months now, Sheik Gumi don take am upon himself to dey enter bushes across northern Nigeria to go meet bandits wey many say dey behind most of di insecurity wahala wey dey trouble northern Nigeria.

According to di Sultan Bello mosque imam, dialogue na di only solution for di kidnappings and killings wey dey happun na why e dey take im message inside bush to go meet dis bandits.

Last month e enter Tsafe forest for Zamfara state and days later Auwalu Daudawa wey lead di Kankara students kidnap for Katsina state repent and give up life of crime.

Minister of Defence: Bashir Salihi Magashi

Wia dis foto come from, BBBC

Wetin we call dis foto, Government Science College Kagara Niger State na Federal Government Unity School