Bea Lewis: Aliko Dangote begin trend afta American woman claim say she date Africa richest man

Bea Lewis

Wia dis foto come from, Bea Lewis

Read am in 2 mins

Aliko Dangote, di richest man for Africa fit be di first man to trend di New Year after one American woman claim say she follow am do boyfriend-girlfriend.

On new year's eve Bea Lewis, wey be Atlanta-based businesswoman for di US enta her Instagram to post: "I date di richest black man in di world.

He break my heart in to 1000 pieces".

Dis for be normal tin and pipo go waka pass, except say di photo wey follow di post come, get Nigerian billionaire Dangote and hersef togeda.

Di photo wey Ms Lewis share of her and Dangote

Wia dis foto come from, Bea Lewis/Instagram

Wetin we call dis foto, Di photo wey Ms Lewis share of her and Dangote

Na dis photo, and oda ones of Dangote make Nigerians carry di mata for head, as many question if true true, di industry giant get romantic relationship wit di American woman.

Dangote never respond or react to di mata. And e no clear whether di dating Lewis dey tok about happen recently or na tey tey.

Lewis, inside di post praise Dangote for di good tins e carry come in life: she say she learn from am pass any oda pesin she don ever meet.

"To dey communicate with billionaire everyday go make you see di world in a different way," Lewis bin tok.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Who be Bea Lewis?

According to her page for LinkedIn, Bea Lewis study Philosophy and Economics for Georgia State University. E no clear if she graduate for 2012 or 2013.

Dem sabi her for Atlanta, because her Hush Dinner Club business wia she dey arrange place for pipo to come chop for night.

She be founder of one company wey dey into food business: Atlanta Meal Prep

Lewis inside one Twitter post say she get daughter.

She also tok about her 'husband' inside one of her social media post.

She be 'Wine Enthusiast' - dis na pesin wey sabi about wine well-well. Lewis dey also do auction for wines wey cost.