World Teachers Day: Nigerian teachers on 5 October get Buhari nod for special salary

Wia dis foto come from, Getty Images
As part of celebration of World Teachers Day on October 5, President Muhammadu Buhari, don approve special salary scale for teachers.
E no end dia, di Presido also increase di years of service for teachers by five years.
Dis one mean say teachers go fit work reach 40 years in service instead of 35 years.

Wia dis foto come from, Presidency
Di minister of education, Adamu Adamu, wey represent di president na im tok dis one during di 2020 celebration of World Teachers Day.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Oga Buhari say di new salary scheme na to ginger di teachers to deliver beta service.









