BBNaija Kiddwaya papa "Terry Waya" say na im discover Banana Island Lagos

Wetin we call dis Video, Terry Waya: Na me discover Banana Island

Many pipo know Terry Waya as Nigerian socialite and billionaire wey sabi throw expensive party to jollificate.

But no be everibodi know say na im discover and get di contract to develop di luxury Banana Island for Lagos, Nigeria commercial capital.

Banana Island na man-made Island wey cover close to 1,630,000 square metres and dem divide am into 536 plots.

Na Lebanese-Nigerian Chagoury Group join bodi alias partner di Federal Ministry of Works and Housing to construct am.

Oga Terry Waya claim say na im dem give di job to develop di area before e hand over to Chagoury to do di job.

Oga Terry reveal dis one wen e dey tell BBC Pidgin News how e take make im money as a young man for Nigeria.

E explain give say nobodi bin know about Banana Island before and dat one day im bin go visit one of im tight friends, General Adisa wey be minister of works den.

As e land di office, e come see one big poster for im back wey dem write -Banana Island.

Im come ask im friend, wetin di poster mean, di general come explain give Terry Waya say dem dey look for partner wey dem go join bodi take develop di Banana Island and then sell am.

Di partner go get im share and di goment go take im own share. Oga Terry add.

Becos of im friendship wit Adisa, e come ask am make im give am di job to do and true-true e come give am di project.

Terry Waya na come decide to call Chagoury to do di project and dis na how dem give birth to di ogbonge Banana Island.

Who be Terry Waya

Terry Waya na BBNaija Kiddwaya billionaire papa wey also be London-based Nigerian businessman.

Oga Waya age 55 bin reportedly face some kain case for British court between 2006 and 2008.

Terry Waya na native of Tiv for Benue State middle belt Nigeria.

Di Nigerian socialite love Versace fashion wella.