Facebook, Google , Apple and Amazon CEO's dey answer query of abuse of power - See di reason why

From left to right; Amazon Jeff Bezos, Tim Cook of AppleFacebook Mark Zuckerberg and Sundar Pichai of Google

Wia dis foto come from, Getty Images/epa/reuters

Di oga dem of four of di most powerful tech giants for di world bin appear before Washington lawmakers to defend dia companies against claims say dem dey abuse dia power to destroy competitors.

Facebook Mark Zuckerberg, Amazon Jeff Bezos, Sundar Pichai of Google, and Tim Cook of Apple bin answer query for more than five hours for di hearing.

Democrat lawmakers bin question di tech ogas about competition mata while Republicans bin dey more concerned about how dem dey manage information and whether dem dey hide views of pipo wey dey conservative.

Wetin be di issue?

One of di congressmen David Cicilline tok say dem do one-year investigation wey show say di online platforms dey "use dia power in destructive and harmful way to expand" dia company.

Im say, di firms dey do monopoly and e call for action.

"Dem need to break up some and all of dem need proper regulation", im tok for di end of di query wey last five hours.

For di hearing, lawmakers accuse Google say dem tiff content wey small-small companies like Yelp bin create, to make users stay for dia own web pages.

Di way Amazon dey treat sellers for dia site, how Facebook take dey buy competitors like Instagram and Apple App store bin also draw attention.

Di top oga dem insist say dia companies no dey do anytin illegal.