Is there lockdown in Port Harcourt: Total lockdown resume on Monday for Rivers State wit some adjustment

- Author, Karina Igonikon
- Role, BBC News Pidgin, Port Harcourt
- Read am in 2 mins
Pipo dey comply to di total lockdown order until further notice for di main bizness district inside Nigeria oil rich Rivers State wey take full effect last night.
Dis restriction order go mainly affect Port Harcourt City and Obio Akpor Local Goment Areas wey be di two LGAs wey get more population out of a total of 23 local goment areas to stop community transmission of coronavirus inside di southern Nigeria state.
Di lockdown resume by 8pm on Sunday ,17 May after di goment lift di first lockdown e declare on 7 May on Tuesday 12 May come extend am to Sunday 17 May evening so dat pipo fit restock dia food and buy medicine for di two local goment wey get di highest population for di State.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
New rules wey follow Rivers lockdown
For dis lockdown, apart from di normal essential duty workers like medical personnel, journalists and security pipo, di state goment give permit to some oda pipo wey dey provide essential services like lawyers wey show proof say dem get court case and Pharmacists with oil and gas service providers too.
Commissioner for Energy and Natural Resources for Rivers State, Dr. Peter Medee say oil and gas workers na essential service providers so members of Nigerian Union of Petroleum and Natural Gas Workers NUPENG, Petroleum Products Retail Outlet Owners Association of Nigeria, NNPC Workers, Department of Petroleum Resources DPR Wokers, Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria IPMAN, Major Oil Marketers Association's of Nigeria and di Depot and Petroleum Marketers Association of Nigeria get permit to waka during di lockdown. Im also warn dis pipo make dem no abuse di privilege if not dem go withdraw di permit.

Di Goment say no be true say di lockdown go last for 21 days as rumour bin fly upandan for social media. Commissioner for Information Paulinus Nsirim say dat one na lie as di State get protocol for di way dem dey take inform pipo about COVID19 either through di Governor wey dey give broadcast or through di Commissioners so any rumour for social media no be true, na just to cause confusion. Im add say di State Security Council dey review how di situation dey and take decision on how long di lockdown go dey.

Meanwhile, all di State borders with oda States still dey closed, markets still dey shutdown and e dey compulsory for pipo to wear facemask before dem comot from dia house.
End of Di one wey oda users dey read well well
As at Monday 18 May, 2020, Rivers State don record 51 cases of coronavirus with 27 active cases. 21 don recover and dem don discharge dem and three pesins don die.












