ART X: Meet di Artist wey say im artwork dey represent di 'gods'

Abe Odedina
Wetin we call dis foto, Abe na Nigerian Figurative Artist for dis year ART X

Abe Odedina na Nigerian Artist wey dey try figure wetin the 'spirits' be for im head.

Im be one of di artists wey dey display im artworks for dis year ART X wey dey house plenti artists for Africa.

Di 59 year old artist na trained architect wey start to dey paint on im trip to Brazil for 2007.

Abe art work

E don turn painting to full time job and im dey use acrylic on plywood.

Abe call im artworks 'Just Looking'.

Abe Odedina dey use acrylic on plywood take dey draw
Wetin we call dis foto, One of Abe works for dis year Art X

Wen BBC Pidgin ask Abe wetin dey im mind as e dey do di artwork, Abe tok say: "I wan make di viewer feel di tension between di past 'Ogun' wey be god of iron, and di future 'Sango' wey be god of thunder."

Abe painting

On if to dey paint pishure dey bring money, Abe say e 'find am (dis kind business) very rewarding'.

Written by: Sarah Tiamiyu