BBC Pidgin Essay Competition 2019: You fit write Pidgin?

BBC News Pidgin don extend di date for dis year's essay competition to now close for Friday, September 13, 2019.
Editor, BBC Pidgin, Adejuwon Soyinka, wey tok dis one for Friday, August 30, say dis extension na to give chance to plenti African students make dem fit participate for di competition.
Students for university, polytechnic or college anywIA for Africa fit chook hand enta inside dis competition wey don tanda for BBC Pidgin website.
Di topic of dis year competition be: "Africa dey ready for female political leadership?"
Students wey wan enter di competition go send dia essay to [email protected]

Adejuwon Soyinka tok say, ''di competition na to motivate and ginger pipo all over West and Central Africa to dey write more and more Pidgin.''
BBC Head of West Africa, Oluwatoyosi Ogunseye, tok say dis na one ogbonge competition wey BBC dey take ginger young pipo to use Pidgin language."
Na di second year wey di tori pipo go do dis kain essay competition.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na from Thursday August 1, submission of entries for di competition go start and e go end for midnight of Friday September 13, 2019.
Na for September 2019 BBC Pidgin go announce winner of di competition.
Click here to see terms and condition: BBC Pidgin everi year essay Competition Terms and Conditions














