Paul Kagame: Oyibo get 'human right superiority complex'

Paul Kagame Rwanda President

Wia dis foto come from, Spencer Platt/Getty

Read am in 2 mins

No be today Rwanda president Paul Kagame begin fire oyibo; weda Americans or Europeans.

Latest gist be say Kagame say pipo wey dey criticise im kontri human rights record dey tok "rubbish."

Kagame wey yan tori pipo France24 dis one say, Rwanda na different kontri compare to wetin e be 25 years ago.

Di Rwanda Presido no end di tok dia, im also challenge di tori pesin wey dey interview am to check wetin im call Europe human rights record wey dey fail especially sake of how dem dey treat migrants.

See oda times wey Kagame fire oyibo word

2016

Afta im get vote for 2016 wey allow am to stay for pawa reach 2034, Presido Kagame give am back to former America president Barack Obama wey criticise im decision to find third term.

More dan 98% of Rwanda pipo vote for di December 18 referendum to remove limit so im go fit extend im time for pawa.

Still, US State Department tok tok pesin John Kirby tok for statement say US dey "deeply disappointed" wit Kagame decision becos im miss opportunity to make democracy solid for im kontri pipo.

Kagame ansa dem back for twitter say "Africa problem, poverty, disease, goment, technology…etc etc no go dey easy to solve by wetin dey behind dis "deep disappointment."

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

2017

One week afta im come back for third term as president for August 2017, Kagame chop plenti accuse say im don follow di footstep of Africa leaders wey dey rewrite constitution to remain for pawa aft aim don rule for 17 years.

For im defence im tell UK tori pipo Telegraph say im no need to convince oyibo say im na ogbonge democrat.

New tin wey im tok

2019

Europe dey violate pipo right as dem dey bundle pipo send dem back to go sink inside Mediterranean and dem dey maltreat many pipo for your own kontri," im tok.

Im add say oyibo dey criticise wit superiority complex:

"You beta stop dis superiority complex nonsense about human rights.

"You tink say na only una one sabi respect human right, all odas dia work na to violate human right. No, we don fight for human right and freedom for our pipo more dan una wey just dey tok about dis nonsense.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Wetin we call dis Video, Femi Falana: 'Nigeria war against corruption na just to confuse pipo'