Bleaching: African kontris wey don ban skin lightening cream

Wia dis foto come from, Blac Chyna/Instagram
"Love di skin wey you get", dis na di message wey Rwanda goment dey sama kontri pipo as dem dey fight against di rise of skin bleaching.
Bleaching creams and soaps na di latest tin wey Presido of Rwanda, Paul Kagame just ban for di kontri afta im begin worry say pipo dey use am anyhow. But Rwanda no be di only African kontri wey don ban bleaching cream.
Dis na some kontris for Africa wey don ban bleaching cream and products wey get harmful bleaching agents.
Ghana - 2016
For 2016, Ghana join di list of kontris wey don ban lightening products wit hydroquinone.
Di kontri FDA say di ban of bleaching creams na mata of public safety.
Ivory Coast -2015
For May 2015, Ivory Coast ban creams wey get any ingredient wey dey whiten pesin skin and creams wey get mercury, hydroquinone wey pass 2%, cortisone and vitamin A.
Di kontri health ministry bin dey worry say lightening creams fit cause hypertension and diabetes.
End of Di one wey oda users dey read well well
Kenya - 1998

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Kenya Bureau of Standards bin ban cosmetics wey get ingredients wey dey harmful to di skin since August 1998.
Some of di ingredients wey dey di list na bleaching chemicals like hydroquinone, mercury and hydrogen peroxide.
Tanzania - 2017
Goment for Tanzania bin ban di importation of products wey get mercury and hydroquinone but pipo still dey smuggle am enta di kontri.

Wia dis foto come from, Getty Images
South Africa
South Africa na also one of di kontris wey don ban skin lightening products wey get plenti mercury, hydroquinone and steroids but pipo still dey buy am from illegal sellers.
Nigeria?

Wia dis foto come from, Getty Images
Just like Ghana, Nigeria also follow ban products wey get mercury, hydroquinone and corticosteroids but dem neva completely ban everi-everi on top skin lightening products.
Upon di ban, around 75% of Nigerian women still dey use bleaching cream according to World Health Organisation.











