Nobel Peace Prize winner for 2018 na African doctor, rape activist

Wia dis foto come from, Reuters
2018 Nobel Peace Prize na Congolese doctor wey dey treat women Denis Mukwege and one Yazidi human rights activist for Iraq, Nadia Murad win am.
Di head of Norwegian Nobel Committee, Berit Reiss-Andersen announce on Friday say di two of dem win am for dia work against di use of rape as weapon of war.
Di Committee say di prize raise awareness of di need to protect women and deal wit pipo wey dey rape.
Around 331 pesins including America Presido Donald Trump and organisations na im dem be nominate for di prestigious peace award dis year.
Who dem be?

Wia dis foto come from, The Washington Post
Afta she escape for November 2014, she start campaign for Yazidi pipo as she wan end human trafficking and ask world pipo say make dem stop rape as weapon of war.
She be di first Iraq pesin to win di war.
Dr Mukwege along wit im colleagues don treat tens of thousands of victims. Him na three-time Nobel Peace Prize nominee for im work wit gang rape victims inside Congo

Wia dis foto come from, Getty Images
Im and im colleagues fit don treat up to 30,000 victims as im be expert to treat serious sexual wound.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dr Mukwege don win oda international prize, like di 2008 UN Human Rights Prize, and for 2009 im be African of di Year.
Ms Murad, wey dey 25 year old, endure three months as sex slave for di hands of Islamic State (IS) militants.
Na buy and sell na im dem trade her several time and force to sex and physical abuse during her captivity.










