ENDSARS na just di beginning, total police reform go be final-final

Nigeria police bin create Special Anti Robbery Squad to fight armed robbery plus violent crimes.

Wia dis foto come from, Twitter/NigerianHive

Wetin we call dis foto, Nigeria police bin create Special Anti Robbery Squad to fight armed robbery plus violent crimes.
Read am in 2 mins

Acting President, Yemi Osinbajo on Tuesday give order to oga police Inspector General Ibrahim Idris to scatter and rearrange Nigeria Special Anti-Robbery Squad (SARS) now-now.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Oga Osinbajo order dey come afta plenti plenti complain wey claim say SARS dey abuse human right.

Since 2017 pipo don dey complain about di kain brutality and harassment wey dem dey suffer for SARS hand. Some even say make goment just scrap di SARS police division as e be say dem no get credibility.

Tori from Laolu Akande, di tok tok pesin Osinbajo say di Acting Presido instruct di Inspector General of Police to ensure that any Unit wey go come out from dis re-arrangement process, go get beta sense to gada infomate ontop security mata wey go only avoid and stop armed robbery, kidnapping and arrest offenders wey get ani fin to do wit all dis bad bad tins only.

Wetin we call dis Video, Rugged man: I enta Shogunle well well

#ENDSARS na just di beginning, total police reform go be final-final - Awosanya

Di chief organiser of #EndSARS, Segun Awosanya say dis talk-talk no end for only twitter or social media.

Wia dis foto come from, SEGUN AWOSANYA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di chief organiser of #EndSARS, Segun Awosanya say dis talk-talk no end for only twitter or social media.

Segun Awosanya, di oga wey carri #EndSARS and #PoliceReform for head don tell BBC News Pidgin say im dey jolli wella on top dis tin wey oga Acting Presido don do.

''Na just Sunday we cari list of wetin we want make oga Presido do on top SARS wahala for di kontri'' na so Awosanya tok.

''Na complete change from head to toe dem go do for SARS, no more SARS, SARS don pafuka''.

Im say di new special team wey go comot from di old SARS go be correct police pipo wey go be friend to Nigerians, wey go serve Nigerians instead of too dey harass dem and im Awosanya team go torchlight dis new special team to make sure dem do wetin dem promise.

Vice President Yemi Osinbajo

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Vice President say dem no go scrap SARS

Awosanya say no be like im team go free police mata, say na just di beginning.;

''#EndSARS dey for our sharp sharp agenda, di one for today but #PoliceReform, dat wan na di long term plan''.

''We go still dey follow National Assembly to pass Police Reform bill, wey don pass first round, to change di whole Nigeria Police wey dey operate wit old constitution from di 1940s.