Buhari: Nigeria opposition PDP say di President no get right to make corruption hard

Nigeria President Muhammadu Buhari

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency

Wetin we call dis foto, Nigeria President Muhammadu Buhari
Read am in 1 mins

Nigeria main opposition party PDP do condemn di asset seizure Executive Order No. 6 wey Presido Muhammadu Buhari sign on 5 July 2018.

PDP on Friday say di order dey illegal and e no follow for wetin dey inside 1999 constitution.

Di party vex waka enta Twitter to blast Presido Buhari

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Buhari don sign order to make corruption hard

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency

Wetin we call dis foto, Buhari don sign order to make corruption hard

Nigeria President Muhammadu Buhari on Thursday declare "national emergency on corruption", as im sign one new executive order to block money wey authorities suspect say come from mago mago.

President Buhari sign di order na to try stop how pipo dey make illegal money, dey sell things wey dem take thief money buy, and na just correct way to block anybodi wey wan kolobi money, im talk.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2