Anoda $500m Abacha tiff moni go soon land Nigeria

Wia dis foto come from, NIGERIA HIGH COMMISSION
Nigeria goment go soon bring back anoda 500 million dollars from Abacha tiff moni.
Dis Abacha tiff moni follow for all di moni di former military presido kolobi comot Nigeria purse.
E follow for di 322 million dollars wey di kontri bin recover from Switzerland from di moni wey General Sani Abacha bin move go oda kontris.
Di kontri Minister of Justice and Attorney General of di Federation, Abubakar Malami on Thursday say "Nigeria don yarn wit UK, US, France plus odas" to tok how to return di moni and dem don almost complet di process to retun $500 million.
For December 2017, Nigeria and Switzerland bin sign agreement for Washington DC to return $322 million to di kontri.








