Nollywood don release im version of Black Panther, "Wakanda Forever"

Wia dis foto come from, Marvel
For Nigeria, fim pipo inside Nollywood wey no dey carry last just release dia own version of di ogbonge fim wey never tey wen e come out, Black Panther
Di fim wey be say na Marvel make am just hammer over 1 Billion dollars and dem bin act am for place wey resemble Africa, wey dem dey call Wakanda. Wakanda Forever na di talk wey pipo for Wakanda dey talk to take salute demsef and e don become sign of Black power and solidarity for di world.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Di Wakanda Forever wey Nollywood just release, na for village for inside Nigeria dem act am, for inside di fim dem use traditional tori style with juju and comedi plus fim-trick take show family and generations for African society.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Many pipo don gada dey talk about dis fim for social media and to watch am for youtube, di fim don draw pipo from different part of di world wey go do anything to connect with Africa.







